Coronavirus: Ghana start dey work towards deployment of Covid-19 vaccines
Wia dis foto come from, NANA AKUFO-ADDO/FACEBOOK
Ghanaian Prez Akufo-Addo set up committee wey go look into de deployment of safe Covid-19 vaccine for de country.
He make dis announcement during en 20th Covid-19 address to Ghanaians.
According to Prez Akufo-Addo, govment go ensure say de Covid-19 vaccines wey Ghana go deploy go be safe for citizens.
He caution citizens say make dem continue to use nose mask den observe de Covid-19 safety protocols during de Christmas celebrations.
De newly elected Ghanaian leader also commend de Electoral Commission of Ghana over how dem follow strict COVID-19 safety protocols during de just ended 2020 elections.
Total Covid-19 infections for Fhana dey stand at 54,643 out of which 52,331 recover wey 331 people die of de virus.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available