You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Festus Adedayo no get regrets say Senate President no appoint am because im yab Buhari
I pass job interview before Nigeria Senate President Ahmed Lawan decide say im go appoint me Media Assistant but I no get hard feelings or regret say I no get di job in di end, Festus Adedayo tell only BBC for interview on Friday.
Latest tori be say di Senate President sack Adedayo as im Special Adviser on Media and Publicity 48 hours afta im appointment.
Festus Adedayo bin trend for Nigeria social media wit #sackFestusAdedayo as many pipo wey be supporters of di goment party APC believe say him no deserve to get di appointment to work wit di Senate Presido afta im don dey criticise di President Muhammadu Buhari goment for long.
"I no get any hard feelings about wetin happun, I tank di Senate President for even to consider me in di first place and I also tank those wey feel say becos I no don dey criticise di APC member I no deserve to get dis appointment"
Afta plenti tweets from party supporters, di Senate President office change di decision to appoint Adedayo and replace am wit Mohammed Isah.
Even di First Lady of Nigeria, Aisha Buhari bin tweet against appointing pipo wey no dey support her husband goment.
Wetin dem do, epp me fulfil part of my life long destiny to become a lawyer, as we dey tok so I dey Law School and wen di appointment bin come, di condition na for me to drop schooling wey go epp become lawyer. I happy e happun like dis so dat I go fit focus on my dream to become lawyer, Adedayo tok.
" I feel fulfilled say all di accuse I chop ontop dis mata na sake of say I dey write against di president and all dis times wen I don dey write, no one don tok say Festus Adebayo na tiff, say e don tiff plenti money so because of dat one, im no dey worthy to become Special Adviser to di Senate President."
End of Di one wey oda users dey read well well
Politics for Nigeria include party loyalty and sentiment of wetin pesin dey do.
Festus Adebadyo say im don dey write articles for newspapers for 19 years and e don be media adviser to two govnors (Oyo and Enugu). And im insist say im no get any hard feelings say im don dey criticize di ruling All Progressives Congress and President Muhammadu Buhari.
I be pesin wey get hatred for injustice. and whereva e be.. wen-eva I gats decide weda to support di public or di establishment, I go always side di public.