You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Senator Ademola Adeleke dey face court charge for exam fraud
Court on Wednesday charge Nigeria dancing senator Ademola Adeleke and four oda pipo unto accuse of exam wayo.
Na for di Federal High Court Abuja dem do hearing for di case.
Senator Adeleke wey contest for Osun state Govnor under di People's Democratic Party deny all di accuse.
Di oda pipo wey di court dey charge na Sikiru Adeleke wey be di principal of Ojo-Ara Community Grammar School, Alhaji Aregbesola Muftau wey be di registrar of di school, Gbadamosi Ojo, and Dare Samuel Olutope wey be teacher for di school.
As e be so, Police don give oga Adeleke bail.