You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Linda Ikeji don born boy pikin
Read am in 1 mins
Nigerian ogbonge news blogger, writer, business woman and former model Linda Ikeji don born baby boy.
Linda wey travel go obodo oyibo America go born her pikin announce di birth of her first pikin for inside her Instagram post dis morning.
Di new mama no waste time to let evri bodi know di name of her tear rubber pikin na Baby J since last week.
Ikeji, wey be Nigeria richest blogger, bin do baby shower last weekend for America as she dey wait for Baby J to show,
Psquare Peter Okoye, Linda sister Laura Ikeji Kanu and her husband dey among di pipo wey gbadun di party.