You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ariana Grande wan marry
American singer, Ariana Grande don confam report say she dey engaged.
Di 24 years old singer confam di tori wit reply to her fans wey dey tweet about her engagement to comedian Pete Davidson.
Pete Davidson, wey dey popula for im role for US sketch show Saturday Night Live, recently draw two tattoos of Ariana - her initials and di bunny ears logo wey dem take know her.
Di couple - wey make dia relationship for Instagram official on 30 May - bin just comot from oda relationships.
One of her fan tweet say, "I hope e know say e dey marry us too."
Then she reply say. "HAHAHAHAHAHH e don get di info."
Ariana Grande wey be 24 years old also thank fans wey dey congratulate her, and even reply to one tweet wey dem for call her Mrs. Davidson.
Di singer even tell fan she dey very happy and excited.
End of Di one wey oda users dey read well well
Pete and Ariana don dey post foto of each oda for dia Instagram since late May.
Two of dem even showface for Kanye West listening party for im new album recently.