You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Italy drive-by attack: Two Nigerians na victims of gunman
Two Nigerians dey among di six African people wey one gunman shoot when im attack people inside di central Italian city of Macerata on Saturday
Italian newspaper Le Stampa na im identify di two Nigerians, with their first names, Jennifer wey be woman and Gideon wey be man. Gideon na 25 years old, while Jennifer na 29.
Nigeria tori agency NAN dey report say di two of dem dey receive treatment for one hospital inside Macerata city.
Hospital people say Jennifer break some of her bone for hand, and dem go do operation to treat her on Sunday.
Le Stampa say Jennifer still dey wonder why di gun man go hit her.