Car crash for London no be terror attack
Wia dis foto come from, AFP/Getty Images
Di crash wey happen for outside London museum wey injure 11 people no get terrorist agenda inside.
One car crash enter where people dey walk for di Natural History Museum for Exhibition Road, South Kensington, at 14:20 BST.
Video wey later comot for inside social media show as di Metropolitan Police arrest one man as dem hold am for ground.
Wia dis foto come from, Reuters
But Police don come out talk say di matter na case of say person get car accident.
Dem say nine people don dey get treatment for inside hospital but e no serious.
Di man wey dem arrest dey for police station for north London.
Prime Minister Theresa May don thank di people wey rush go di area immediately di thing happen.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available