You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Arsenal transfer news: "Thomas Partey" move to Arsenal FC Gunners from Atletico Madrid almost dey sealed
Arsenal dey try conclude deadline day deal for long-term target Thomas Partey from Atletico Madrid.
Di Ghana international midfielder, get release clause of £45m.
Partey, wey join Atletico for 2011, don make 35 league appearances for Diego Simeone team.
Partey, bin win di 2017-18 Europa League and 2018 Super Cup with Atletico, and e just even sign new deal for di Wanda Metropolitano for 2018, until di end of June 2023.
Yet e be like say Arsenal ready to force Partey to port before im contract end.
If pesin dey wonder say why Arsenal go wan comot big money buy di midfielder on transfer deadline day, we get some ideas why:
Obonge passing
Partey na midfielder wit di ability to pass short and long wit quality.
End of Di one wey oda users dey read well well
Goals
English football like players wey fit tear shot to score, and Partey sabi am well well.
Bravery
E dey very intelligent in di way e dey move, and im tackle dey very precise. Ontop that im brave in di way e dey press high.
One-touch football
Na footballer wey dey strong, and fast, and di way im dey handle ball wit im leg, no get part two.
Team helper
Many don praise how Partey dey ginger im teammates to play well because e dey bring energy come.
Among di completed deals, di Gunners don so far buy Brazilian defender Gabriel Magalhaes for 26m euros (£23.14m) from Lille.