You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria Super Eagles go meet President Buhari today
President Muhammadu Buhari go meet with Nigeria Super Eagles wey dey go Russia 2018 World Cup on Wednesday for di Presidential Villa.
Dem suppose do di weekly meeting of di Federal Executive Council but dem don replace am with dis meeting wey go give di president di chance to tell di team bye bye before dem leave Nigeria for di World Cup.
Minister of Sports, Solomon Dalung, go present dem to Buhari, before di Eagles travel go London wia dem get friendly against England for Wembley Stadium on Saturday.
Di team go play dia final World Cup friendly against di Czech Republic on Wednesday next week.