You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Roma v Liverpool: Five tins wey happen for Stadio Olimpico for Champions League
Liverpool don qualify for Champions League final for di first time since 2007.
Even though say dem lose to AS Roma last night for Rome e no affect di final result of 7-6 over two legs.
Mane bost net
Sadio Mane score di first goal of di match to give di visitors dem di lead for Rome inside 10 minutes.
E make am im goal number nine for di competition.
James Milner score against Liverpool
James Milner make mistake score im own goalkeeper afta Roma player Stephan El Shaarawy cross dangerous ball inside di box wey level di score of di match to 1-1.
Nainggolan ginger no reach
End of Di one wey oda users dey read well well
Radja Nainggolan score im first goal for Champions League come add anoda one for injury time but im goals no help im team.
Nainggolan make mistake wey make Liverpool score dia first goal im later apologise to di fans for social media.
Liverpool break Roma clean sheet record
Na 10 minutes e take Liverpool to break Roma clean sheet record for house afta dem don play last five Champions League match dis season wey dem neva score dem.
Liverpool 7-6 final score to Roma break record
With 13 goals for di two legs, dis na di highest scoring Champions League semi-final ever, e don overtake Monaco v Juventus wey finish (4-6) for 1998.
Liverpool go face Real Madrid for Kyiv 26 May.