Tinubu go visit Jos, police gbab suspects and oda tins wey don happun since deadly Plateau attacks

Read am in 3 mins

Nigeria President Bola Tinubu don cancel im trip to Iperu, Ogun State, southwest Nigeria as e announce say e go dey for Jos, di Plateau State capital, to commiserate wit di families of pipo wey lose loved ones to di attacks wey recently happun and claim ova 20 lives.

President Tinubu give di informate on im X account on Wednesday 1 April.

"I go dey for Jos to commiserate wit families wey don lose loved ones and to reaffirm say dose wey seek to spread fear no go prevail. We go continue to strengthen our security response and ensure say justice dey done," e tok.

E say from Plateau, im go "proceed to Lagos to observe Good Friday, and den continue wit scheduled engagements for Ogun, Lagos, and Bayelsa focused on infrastructure, trade, and economic growth".

Di deadly attack happun on Sunday 29 March and kpai ova 20 residents and injure many odas for di Gari Ya Waye community of Angwan Rukuba.

Di Commissioner for Information and Communication, Rt Hon Joyce Lohya Ramnap, say di govment condemn di "barbaric and unprovoked attack on innocent citizens".

Di Plateau State Govment bin impose 48 hours curfew on Jos North Local Govment Area afta di deadly attack for di Gari Ya Waye community of Angwan Rukuba.

Rt Hon Joyce Lohya Ramnap wey be di Commissioner for Information and Communication, , say di govment condemn di "barbaric and unprovoked attack on innocent citizens".

Di curfew bin take effect from Sunday midnight and last till Wednesday 1 April.

Afta di end of di curfew, anoda violence happun on Wednesday for some areas for Jos metropolis as local tori pipo say at least one pesin don kpai and panic don spread for several neighbourhoods for Jos North.

"In moments of grief, we gatz stand togeda. In moments of progress, we gatz keep building. Di work continue. Nigeria First," e tok.

Tinubu receive Plateau State govnor for Presidential Villa, police arrest suspects

Bifor im announcement say im go visit Plateau, President Tinubu on Wednesday bin receive di state Govnor Caleb Mutfwang, for di Presidential Villa for Abuja.

Di meeting bin focus on immediate security measures to prevent further attacks for Plateau State.

On Wednesday, di Plateau State Command of di Nigeria Police Force confam say dem gbab one suspected fake soldier and five odas in connection wit di tension wey rock parts of Jos on dat day.

Di Police Public Relations Officer, Alfred Alabo, say di suspect, wey bin wear army singlet and one extra shirt, chop arrest for Angwan Rukuba, di same community wia several pipo kpai and injure.

E say dem gba di suspect as e dey roam suspiciously for di area on Wednesday afternoon and dem find fake Nigerian Military School (NMS) identity card for im hand.

Alabo say five oda pipo also chop arrest in connection wit unrest across di Jos metropolis on Wednesday, and e describe dem as hoodlums wey bin exploit di situation to engage in criminal acts.

We dey update dis tori