Wetin be Inec resolution wey comot David Mark as national chairman of Nigeria leading opposition ADC

Read am in 4 mins

Di Independent National Electoral Commission (Inec) tok say dem go remove di name of David Mark-led faction of di African Democratic Congress (ADC) from dia portal and di commission no go monitor any congress or convention by di party.

Inec say dem go comot di names of all di National Working Committee of ADC wey dey dia portal until di party finish dia case for court.

Dis dey come as David Mark-led faction of di ADC and Nafiu Bala Gombe-led faction dey drag matter of who be di leader of di party.

For July 2025, some popular politicians gada to unveil di African Democratic Congress (ADC) as dia chosen party for di coalition to face di ruling All Progressives Congress, APC for di 2027 election.

During dat meeting, Ralph Nwosu, di founder and pioneer Chairman of di African Democratic Congress (ADC), officially handover di mantle of leadership give di former Senate President David Mark, as di interim National Chairman of di party while former Osun state Govnor Rauf Aregbesola go serve as di interim National Secretary.

Howeva, Nafiu Bala Gombe carry di matter go court say na im suppose be di leader of ADC sign all oda executive members don resign. E write to di court say make Inec no recognise David Mark and im pipo as di leader of di party.

Wetin Inec tok

Inec tok say David Mark camp write through dia legal chamber say make dem no recognise any ADC activity by Nafiu Bala Gombe, and make di commission no recognise am as acting National Chairman of di party.

Naso Nafiu Bala Gombe write im own back through im own legal chamber say make di commission no recognise David Mark and Rauf Aregbesola neational leadership of ADC.

Dem carry di matter reach Court of Appeal, wia di court come rule say make Inec no recognise David Mark and Rauf Aregbesola as leaders of di party, make Inec comot dia names from dia portal and make Inec no deal wit dem in any activity of wey concern di party.

Nafiu Bala Gombe say im no resign from di party, and as per say im be di only National Vice Chairman wey dey di party bifor dem David Mark come, na im suppose dey recognised as di acting National Chairman of ADC.

For 12 March, 2026, di Court of Appeal throway di appeal wey David Mark and say make di party maintain status quo.

Inec say dem refuse to agree make Nafiu Bala Gombe to take ova affairs of ADC until di case don dey determined.

Inec resolution on ADC

Inec say; "Since di names of di current National Working Committee members wey Senator David Mark bin dey uploaded on 9th September, 2025 by INEC, we go remove di name from di Inec portal, wey dey according to di Court of Appeal to maintain di status quo til di trial court decide di mata."

"Di Commission tanda gidigba for dia commitment to neutrality, impartiality and strict compliance wit judicial orders," di commission add.

Dem say make political parties and stakeholders dey arrange demselves well-well so e no go scata di Electoral time table for di 2027 general election.