Peter Obi rate Tinubu visit to Jos, but wetin dey cause attacks for Plateau State?
Wia dis foto come from, Peter Obi/Bola Tinubu/X
Di 2023 Labour Party Presidential Candidate, Peter Obi don comot to yab di manner wey President Bola Tinubu take visit di victims of di Plateau state attacks say e no get human feeling,
On Friday, oga Obi write for im X account say "wetin happun for Plateau yesterday torchlight complete abscence of leadership, True leadership need patience, empathy, compassion and willingness to go meet wit do wia dia pain dey."
E add say "for citizens wey just loose dia loved ones, homes and dia sense of safety, to follow dem tok from airport tarmac, no dey enough at all, at all."
Dis callout dey come afta Nigeria President Bola Tinubu bin land for di Jos airport to make im remarks ova wetin happun dis week for Plateai state
Obi also reference di kain waka wey di President bin make to Benue State for 2025 wia e bin no visit wia di attack happun gan-gan.
E tok say "dis kain waka dey ginger di sense of abandonment wey innocent Nigerians wey don endure repeat in cycle of violence without any meaningful protection or justice. Plateau state deserve pass distant words, e need urgent action and clear commitment to ending di kasala wey dey contine to gbab innocent lives".
Di former Anambra State govnor tok-tok dey vomr afta Tinubu collect gbas-gbos for im visit go Jos wia e bin meet di victims of di attack from di airport.
All dis dey come afta a Palm Sunday kasala for di Angwan Rukuba area of Jos North Local Government Area of Plateau state wia gunment bin attack and kill at least 28 pipo wit many injured.
Dis na just one in di kasala wey don dey burst for Plateau state for long as di gbas-gbos dey suspected to be about ethnic, religious and land dispute mata.
Wetin happun for Tinubu trip to Plateau State
Wia dis foto come from, @aonanuga1956/X
President Tinubu bin go Jos on Thursday 2 April to commiserate wit di families of pipo wey lose dia lives for di attacks wey happun on Palm Sunday and Wednesday 1 April.
President Bola Ahmed Tinubu say di best solution na for Jos to return to di peace and stability wey pipo sabi am for.
E tok dis one wen e visit Jos afta di killing of pipo on Sunday.
Di President say no amount of mourning fit bring back loved ones wey don kpai, and remind dem say dem dey elect leaders to bring peace and prosperity, no be to create widows and widowers.
Tinubu maintain say im presence no be just to commiserate, but to promote lasting peace, adding say such incidents must not happun again.
President Bola Tinubu den direct all service chiefs to identify and bring to justice di killers wey dey behind di recent attacks for Plateau State.
E also promise say govment go install 5,000 cameras to improve security surveillance for Plateau State.
President Tinubu tok for di meeting wit stakeholders and victims of di attacks as e console wit di victims and call on state govment to do beta.
Wetin dey cause attacks for Plateau State?
Di kasala for Plateau get im own doings. Di state get historic links to American missionaries. Di state get ova 50 ethnic groups. Christians na di majority but Muslims yapa too.
For decades, local politicians dey run pipo street in dia search for power by using pipo ethncity and religion.
Di pipo wey dey seen as "indigenes" by di local authorities dey get beta access to work and land, dis na pipo wey come from mostly Christian ethnic groups.
But di pipo wey dem call "settlers" include many wey come from Muslim communities like Fulani pipo and na dos settler dem go call even pipo wey don dey dat land for generations.
For 2001, community kasala bin spark for di state capital, Jos and ova 1,000 pipo kpai and both Muslims and Christians bin dey force to ja.
Di kasala enta villages and drag different ethnic groups enta di kwente.
But e no easy to keep peace. One of di main cause of di fight na land fight. Dis issue na round Nigeria e dey and e dey normally put famers and herders leg inside one trouser no mata which religion dem be.
So for Plateau and oda parts of central Nigeria, most farmers na Christian ethnic groups while most herders na Muslim Fulanis.
Dis dey make so small fight fit ginger old wounds wey go create bigger kasala.
Traditionally, di relationship between herders and farmers dey mutual. Cows bin dey allowed to graze for farms afta harvest and dia manure dey help fertilise di land.
But wit di way Nigerian population dey grow, more land dey farmed and old grazing area don lost and water sources don dey scarce.
For areas wia kasala dey, farmers don accuse herders say dem dey destroy crops on purpose. While herders dey accuse say dem dey tiff and kill dia cows.
To solve di wahala, di goment don launch peace initiatives and to promise to boost security. Dem don do medition and peace deals.
Wen e come to mata of peace, na elders dey do di toking cos na dem get influence pass.
Di kasala for Plateau get im own runs o but insecurity don scata plenti parts of rural Nigeria.
As far as villagers sabi, di koko of di issues na di absence of govment, of justice and of trust for security forces. Dos tins go dey hard to fix.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available