Trump say 'whole civilisation go kpai tonight' if Iran no make deal as US strike Kharg Island
Wia dis foto come from, Brendan SMIALOWSKI / AFP via Getty Images
Donald Trump don warn say a "whole civilisation go kpai tonight" unless Iran make deal on reopening di Strait of Hormuz.
But di US president add say "somtin revolutionarily wonderful fit happun" bifor im deadline of 20:00 on Tuesday (EDT) for Iran to reopen di key shipping channel.
E post on Truth Social: "A whole civilization go kpai tonight, neva to dey brought back again".
E go on:
"I no wan dat to happun, but e fit happun. However, now wey we get Complete and Total Regime Change, wia different, smarter, and less radicalized minds prevail, maybe somtin revolutionarily wonderful fit happun, WHO KNOW?
"We go find out tonight, one of di most important moments for di long and complex history of di World. 47 years of extortion, corruption, and death, go finally end. God Bless di Great Pipo of Iran!"
Meanwhile di US don carry out new strikes on military targets on Kharg Island, Iran key oil export terminal.
Israel warn Iranians say make dem no travel by train - and say e dey "endanger your life" - and also confam one attack one third petrochemical site
Di number of pipo wey don kpai for Iran since di US-Israeli attacks begin don pass 3,500, including at least 1,665 civilians, one US-based human rights group tok.
Meanwhile, Iran say dem don formally reject one US ceasefire proposal, state media report - while sharing one list of demands.
US official don confam to CBS News say American forces conduct strikes on military targets on Iran Kharg Island.
Di US previously target di island for March, and President Trump say dem don destroy military targets.
Official tell CBS - di BBC US news partner, say oil infrastructure no dey targeted for di overnight attack.
Kharg Island na home to one major oil terminal wey dey considered for Iran economic lifeline.
Trump also previously indicate say e fit send troops to seize control of di island.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available