Aisha Alhassan "Mama Taraba" dead: Buhari former Minister of Women Affairs don die
Wia dis foto come from, Other
Aisha Jummai Alhassa, Nigeria former Minister of Women Affairs AKA Mama Taraba don die
Hajiya Alhassan pass away for hospital for Cairo wey be capital of Egypt on Friday due to undisclosed illness.
Her sister confam tori of di death to BBC but no give additional information about cause of death.
Wia dis foto come from, @SenAishaAlhassn
Hajiya Alhassan serve as women affairs minister under president Muhammadu Buhari administration from 2015-2018.
She resign to go contest govnorship election for her home state of Taraba for northern Nigeria.
Before then she bin also dey Senate between 2011- 2015 as one of di only four women wey dey senate dat time.
Wia dis foto come from, Senator Jummai Alhassan
After di female politician leave goment for 2018 she decamp from di ruling APC.
She contest 2019 govnorship under UDP before she lose to present Taraba govnor Darius Ishaku of PDP.
End of Di one wey oda users dey read well well
Mama Taraba death make many Nigerian leaders sad wen di news break on Friday evening.
Govnor Darius Ishaku and President Muhammadu Muhari her former boss, dey among those wey express sadness.
Wia dis foto come from, Screenshot
Wia dis foto come from, Screenshot
Wia dis foto come from, Screenshot
Wia dis foto come from, Screenshot
Wia dis foto come from, Other
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available