"Zendaya" win "Emmy awards 2020" as youngest woman to win am during 67th Primetime Academy ceremony for role as lead drama actress

Read am in 1 mins

Former Disney star Zendaya bin make history on Sunday, 20 September as she become di youngest woman to win best actress for drama series for di Emmys.

Di 24-year-old actress become di youngest woman to win best actress for drama series award for di feem - Euphoria.

Sharp-sharp, pipo begin congratulate her for social media.

Three tins you suppose sabi about Zendaya

  • Before Zendaya Coleman blow for 2010 for her role as Rocky Blue for Disney Channel show, 'Shake It Up', she bin dey do child model and backup dancer.
  • Wen she no dey act, she dey break record wit her music career. Her song 'Rewrite the stars' bin reach top twenty for UK and Australian national charts and e go platinum for di US and double platinum for Australia.
  • She no dey chop meat at all as she be vegetarian.