You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
El-Rufai: Kaduna State Governor don put im pikin for public school
Governor of Kaduna state, Nasir El-Rufai don carry im six-year-old son Abubakar Al-Siddique put for Kaduna Capital School, one of di public primary schools wey dey di state.
Di state governor bin announce am for Twitter on Monday, September 23.
Dis na part of El-Rufai 2017 campaign promise to send im pikin go public school to show say im get am for mind to fix public education for di state and raise dia standard.
Even though El-Rufai plan na to use imsef do example, some pipo for social media feel say di Governor just dey play politics.
Weda na politics or not, some Nigerians feel say wetin di Governor do deserve tuale.