You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Shatta Wale: See how Ghana dancehall star propose to Michy
Ghanian singer Shatta Wale jump ontop stage to propose to im baby mama Michy wey dey perform on Saturday night.
Na for di "Reign Concert" wey happun for Fantasy Dome, Kpeshie Accra di singer propose.
Video of how Ghana dancehall star propose to Michy don scatta social media for di west African kontri.
Crowd wey full ground for di concert and album launch no fit control tears wey dey comot from dia eyes as di music star propose to im lover in front of dia small pikin wey im name na Majesty.
Michy wey dey surprised for di whole drama open im mouth dey look and later kiss Shatta Wale for like one minute.
Afta di proposal di two lovers join hand perfom one song "Low Tempo" and Shatta Wale later perform anoda song "Bulletproof" wey im use assure Michy of im love and security.
Di proposal happun di time wey pipo dey tink say di two lovers dey plan to separate sake of say Michy bin tell her fans make dem no dey tag am wit di Shatta Wale brand, say she wan be her own self.
All dis begin afta tori comot say Shatta Wale assualt im lover Michy.
End of Di one wey oda users dey read well well