Burna Boy homecoming: Damini Ogulu AKA "Burna Boy" Grammys homecoming concert fotos from Port Harcourt

Burna Boy, di Grammy award-winning singer land Port Harcourt, Rivers State Nigeria for im homecoming concert.

As di Nigerian singer [Burna Boy] make history on Sunday, 14, March, win im first ever Grammy, pipo and goment for im home state dey organize concert for am on Saturday 27 March, 2021.

Na Burna boy 'Twice As Tall' 2020 song win am di 'Best Global Music Album' category for di 63rd Grammy Awards, so Rivers State Government stage di event to honor im global musical achievements.

Di event go happun for EUI Event Centre Sani Abacha Road GRA, Port Harcourt. And alongside di Grammy-winning singer, Duncan Mighty, Timaya, Omah Lay, and Nissi go perform.

See Burna boy homecoming fotos from Port Harcourt