You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria vs Cameroon: Super Eagles don qualify for Afcon quarter finals
Nigeria Super Eagles qualify for di quarter finals of di Africa Cup of Nations on Saturday after dem beat di Indomitable Lions of Cameroon 3-2 for Alexandria.
Nigeria striker Odion Ighalo score two goals before Alex Iwobi complete di scoring for di Super Egales.
Nigeria go jam di winner between host Egypt and South Africa for quarter finals on July 10.
Cameroon enta di 32nd Africa Cup of Nations as di defending champions but meet di end of di road for Alexandria Stadium on Saturday evening.
Nigeria presido Muhammadu Buhari don sam congratulobia give di Super Eagles.
Before di game start, Super Eagles coach bin tell BBC say im boys go enta di match wit fighting spirit.
Dis na as di match bin happun:
Odion Ighalo score di first goal for Nigeria inside di 19 minute of di game.
Bahoken score di first goal for Cameroon for 41 minute of di first half.
End of Di one wey oda users dey read well well
N'jie make di Indomitable Lions roar wit anoda goal for di 44 minute.
Ighalo 63 minute goal make di Super Eagles level up wit di Indomitable Lions wit a second goal.
Three minutes later Alex Iwobi tear di Cameroon defence wit Nigeria third goal for 66 minute.