You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Cristiano Ronaldo: Di striker don chop fine from Uefa for im goal celebration
Juventus striker Cristiano Ronaldo don chop 20,000 euros fine (£17,700) from Uefa.
Di fine na for im goal celebration against Atletico Madrid for dia round of 16 Champions League match.
Di 34-year-old bin copy wetin Atletico coach Diego Simeone, bin do wen im turn face di fans dem and put im hand for im leg area wen im team win 2-0 for di first leg.
Ronaldo do di same tin as im score hat-trick for dia return leg wey Juventus win 3-0.
Di Portuguese international player don score 124 goals for Champions League.
Uefa bin fine Simeone £17,000 for dis same celebration.