Ramaphosa appoint Puleng Dimpane as acting police commissioner to replace Fannie Masemola

Foto of Cyril Ramaphosa and Puleng Dimpane as dem stand for podium

Wia dis foto come from, @SABCNews

Read am in 3 mins

South African President Cyril Ramaphosa don appoint Lieutenant General Puleng Dimpane as di Acting National Police Commissioner.

Dis na afta di president place Fannie Masemola on precautionary suspension, pending di finalisation of di case e dey face.

Masemola dey face four charges under di Public Finances Management Act.

Earlier, dis week Masemola bin appear for court ova im role in di contract wey dem give to Vusimuzi "Cat" Matlala's Medicare24.

On Thursday, Ramaphosa appoint Puleng Dimpane as di Acting National Police commissioner wen e dey address tori pipo for Pretoria.

Ramaphosa tok say im govment don take step to stop corruption among senior officers and becos of di seriousness of di charges against Masemola e go dey on "precautionary suspension pending di conclusion of di case."

E add say dia effort na to ensure say law enforcement agencies go fit act rightly without any fear, favours and prejudice

Di president tok say to ensure say leadership run smoothly in di South African Police Force im don appoint Puleng Dimpane to replace Masemola.

"South African Police Service, national police commissioner Fannie Masemola dey face charges of contravention on di public finance management act," Ramaphosa tok.

"In consideration of di seriousness of dis charges and di critical role di national police commissioner dey play in leading di fight against crime."

"I don agree wit General Masemola say e go dey on precautionary suspension pending di conclusion of di case."

"To ensure stability and continuity in di South African Police Force, I don appoint Lieutenant General Puleng Dimpane as di Acting National Police Commissioner."

While, addressing tori pipo Ramaphosa tok say Dimpane bin serve as di Chief Financial Officer in di South African Police Services.

Di president tok say she get reputation in professionalism and intergrity and e dey confident say she get di qualities and resources to provide effective leadership to di South African Police Service.

Ramaphosa task di leadership within di police service make dem address di weakness in procurement system for goods and services in di police service.

Di president tok say procurement don become source of corruption of office and instability within di police service.

"Di minister of police go support di work wey di South African police leadership, must now under take to insinuate procurement processes from any form of manipulation," Ramaphosa tok.

"Di acting national police commissioner dey expected to substain di momentum of di national fight against crime and corruption."

Wetin be di allegations against Fannie Masemola?

Masemola dey face criminal charges linked to alleged violation of di Public Finance Management Act

Wia dis foto come from, Frennie Shivambu/Gallo Images via Getty Images

Fannie Masemola, 62, dey face four-count charges, ova one controversial $21m (£15.5m) health contract, wey dey under investigation.

Dem don charge am wit violation of South Africa Public Finance Management Act wey dey govern how dem take dey spend taxpayers money.

Masemola tell tori pipo afta di hearing on Tuesday, say e deny di charges against am.

'I know say I no dey guilty, I no do any wrong, but di [law] go take im course,' e tok.

E neva plea to di charges agianst am, bur e fit face up to five years for prison, if dem find am found guilty.

Masemola na di third South Africa police chief wey don face criminal investigation while e still dey for office.

Who be Puleng Dimpane?

Lieutenant General Puleng Dimpane bin serve as di Chief Financial Officer in SAPS.

She don dey wit SAPS for almost twenty years afta she join in 2007 as an internal auditor.

She get Bachelor Degree in Commerce as well as Honours Degree for Business Administration.

We still dey update dis tori.........