Why South African court order Zambia to return former president Edgar Lungu bodi

Head and shoulders image of Edgar Lungu. Im blue collar and dark jacket show for di bottom of di picture.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Edgar Lungu say im no want im successor for im funeral or "anywia near" im bodi
    • Author, Damian Zane
    • Author, Wedaeli Chibelushi
  • Read am in 4 mins

Just hours afta di Zambian govment announce say dem don take possession of ex-President Edgar Lungu bodi, one court for South Africa - di kontri wia Lungu die - don order say make dem return di bodi.

Dis na di latest twist for inside one 10-month saga on top wetin suppose happun to im remains afta one long-standing battle between Lungu and im successor, President Hakainde Hichilema.

Di govment for long don maintain say as a former head of state, Lungu suppose dey honoured for di kontri and dey buried alongside im predecessors for di special presidential burial ground for di capital, Lusaka.

But Lungu family want private burial afta all di tok-tok wit di govment on top im funeral arrangements no work out.

Last August, South African high court for Pretoria bin rule say Zambia govment fit repatriate di bodi and give am state funeral - one outcome wey leave Lungu relatives visibly disturbed for di courtroom.

Di family appeal against di decision but, for inside one surprise announcement late on Wednesday night, Zambia govment tok say di South African court don "formally transfer" Lungu remains to di state.

According to di statement, di transfer happun afta Lungu family bin no fit "continue wit dia case" for di appeals court.

But just few hours later, di same South African court order di Zambian govment to return di bodi until di mata go back court on 21 May.

To make di mata worse, Two Mountains Burial Services, di funeral home wia dem bin originally keep Lungu bodi don tok say dem no go accept am again, and don ask di Lungu family to find alternative.

For one interview on Zambian YouTube news channel, Lungu family tok-tok pesin Makebi Zulu bin no gree say di appeals process fail, e say dem follow di correct procedure.

Di former president bin die of one undisclosed illness for di age of 68 for one clinic for South Africa capital, Pretoria.

Kasala burst afta im death, as mourners begin receive different information from di govment and Lungu political party, di Patriotic Front (PF).

Two separate mourning periods bin dey announced and at one point, competing condolence books dey.

Lungu, wey lead Zambia from 2015 until 2021, get plenti disagreements wit Hichilema, wey be di opposition leader for many years bifor e finally unseat im bitter rival.

After Lungu death, im family tok say di ex-president no want make Hichilema attend im funeral or dey "anywia near" im bodi.

Why di funeral arrangement of Lungu turn court case

Afta Lungu death for South Africa at di age of 68, di family wan dey in charge of di funeral arrangements, wey include bringing back im bodi, but di Zambian authorities wan control evritin.

Afta plenti back and forth, di govment and di family later agree say e go get state funeral, bifor disagreement enta ova di exact arrangements, all dis wahala make di family decide to bury di late president for South Africa.

For one address, President Hichilema tok say Lungu, as former president, "belong to di nation of Zambia" and im bodi therefore suppose "dey buried for Zambia wit full honours, and no be for any oda nation".

However, because of di row, e announce immediate end to di mourning period, e say di kontri need to "resume normal life".

"Di govment don do evritin possible to engage wit di family of our departed sixth president," e tok.

Di national mourning period initially run from 8 to 14 June but dem later extend am until 23 June, wit flags flying at half-mast and radio stations playing solemn music.

President Hichilema and senior officials bin read yto receive Lungu coffin wit full military honours.

However, Lungu family block di repatriation of im remains for di last minute, dem say govment go back on dia agreement ova di funeral plans.

Di current disagreement ova Lungu burial highlight di tense relationship between im and im successor, wey play out in life and continue even in death.

Wen Lungu be president, e lock Hichilema up for more dan 100 days on treason charges afta Hichilema motorcade allegedly refuse to make way for am.

E bin take di intervention of di Commonwealth bifor e release Hichilema. Four years later, and afta five attempts at presidency, Hichilema defeat Lungu.