You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Mane goal book Afcon final spot for Senegal
Senegal don reach di final of di 2025 Afcon afta dem defeat Egypt 1-0.
Sadio Mane score di only goal for di 78th minute afta he shoot from outside di box.
Egypt keeper El Shenaawy no see d ball bifor e crash into di net.
Liverpool forward Mohamed Salah bin complain say di ball don hit di hand of Mane bifor he shoot.
Afta VAR check, di goal stand.
Bifor dat goal, Senegal don play four shots on target, Egypt neva get single shot until di final 10 minutes.
Dem sit back wey dem dey soak di pressure and waiting for counter attack wey no really help dem.
Even as dem push to get di equalizer, Senegal hold on to secure all three points and book dia place for di final.
Dis be di second time dem dey reach di final afta dem reach di 2021 final and win di tournament, dia first eva trophy.
Road to di semi-final
Senegal bin don play all dia five games for Tangier – dem win four of dia five games to reach di semis.
Dem beat Botswana 3-0, wey dem draw 1-1 wit DR Congo bifor dem defeat Benin 3-0 and den anoda 3-1 against Sudan for di R16.
Di Teranga Lions also beat Mali 1-0 for di quarterfinal.
Dem score a total of 11 goals in di process when compared to di nine goals from Egypt.
Di Pharaohs first beat Zimbabwe 2-1, wey dem sama South Africa 1-0 and draw 0-0 wit Angola for di group stage.
Dem later beat Benin 3-1 wey dem also beat defending champions Cote D'ivoire 3-2 for di quarterfinal to reach di semis.
Both teams get good attacking power wey dem go jam to see who go come on top and reach di final.
Wit dis win now, Senegal now get six wins, three draws and seven defeats versus Egypt.
Egypt neva get dia revenge from dat 2021 final when dem lose to Senegal.
Wit dis Wednesday result, di Pharaohs now fail to win dia eighth title wey dem dey pursue since 2010.
Senegal v Egypt Head-to-head
Across 15 games bifor now, Egypt dey lead wit seven wins, Senegal get five wins wey di three oda games end for draw.
For di Afcon, dem meet each oda five times - wey dem all win two games each and one draw.
Dis dey show say dis game na ogbonge football game.
Dia most recent meeting happun for di 2021 Afcon final for Yaoundé when Senegal beat dem for penalties to win dia first ever trophy.
Dat defeat pain di Pharaohs well well as dem fail yet again to win dia eighth title wey dem dey pursue since 2010 when dem win dia last Afcon.
Dem lose di final for 2017 also.
Many pipo tink say Egypt dey enta dis game wit revenge and unfinished business from 2021 – odas tink say Senegal wan show say dem too be big boys for Africa.
Team news and key players for dis game
Liverpool star Mohammed Salah bin dey chase his first ever Afcon title – so far he bin don lead di Pharaohs well for dis competition wit four goals - altogeda, di Egyptian captain get 11 Afcon goals.
But for di five times he don face di Teranga Lions, Salah neva score against dem; he bin hope say dis be di time to break dat bad luck.
His former Liverpool teammate Sadio Mane now don face Egypt six times – he score two goals wey he win four times, wit one defeat and one draw.