Fifa World Cup play-offs - who dey play who?

Italy team rejoicing

Wia dis foto come from, Mattia Ozbot/Getty Images

Read am in 4 mins

E don dey confam say DR Congo dey face Jamaica for di Fifa 2026 World Cup intercontinental play-offs.

Di Congolese wey appear last for di 1974 World Cup wen dem compete as Zaire, get Newcastle Yoane Wissa, Sunderland Noah Sadiki and West Ham Aaron Wan Bissaka, and dey hope for anoda World Cup.

Rememba say DR Congo beat Nigeria to extend dia bid to reach di 2026 Fifa World Cup afta for di African playoff final.

Jamaica beat New Caledonia for di semi-finals of di play-offs wey dem play for Thursday, 26 March 2026.

On di oda hand, Bolivia beat Suriname wit two goals to one, to qualify for di finals of di intercontinental play-offs.

Iraq go battle am out wit Bolivia to fit find dia spot for di Fifa 2026 World Cup.

Bolivia don qualify for three World Cups, including di first tournament for 1930, but dem neva get anoda opportunity since 1994.

Di two teams wey go win for dis intercontinental tournament go dey happy to proceed to di main tournament as dem go dey go dey added into groups I and K.

Na six spots remain for di 2026 Fifa World Cup wey go happun for di United States, Mexico and Canada and e go dey decided dis month.

Four European nations go get di chance to qualify through di play-offs, and e go happun through semi-finals and den final.

World Cup qualifiers European finals - who dey face who

Four kontris still get di chance to qualify for di 2026 World Cup from dis European play-offs.

Alreadi, eight kontris don qualify for di finals of di European qualifiers- Turkey, Czech Republic, Denmark, Italy, Poland, Kosovo, Sweden and Bosnia-Herzegovina

Italy neva qualify for di World Cup afta dem finish runners-up for dia qualifying group. Dem gatz win dia next match to fit qualify for di 2026 World Cup.

Denmark too get anoda chance to break dia way into di 2026 Fifa World Cup, but na if dem win dia play-offs final match.

Di European semi-finals take place on Thursday, 26 March and di finals go sup for Tuesday, 31 March, den di play-off winners go enta World Cup groups A, B, D, and F,

FIFA World Cup Qualifying - European finals fixtures

Tuesday 31 March 2026

  • Bosnia-Herzegovina vs Italy kick off 19:45
  • Czech Republic vs Denmark kick off 19:45
  • Kosovo vs Turkey kick off 19:45
  • Sweden vs Poland kick off 19:45

Four winners from here go proceed go di 2026 Fifa World Cup.

Who fit qualify from di 2026 World Cup intercontinental play-offs?

Six nations from five different confederations get di final opportunity to book dia spot for di 2026 Fifa World Cup through two pathways.

Di two teams wey go win for dis intercontinental tournament wey go feature di winner of di African playoff go face di winners from Bolivia, New Caledonia and two teams from Central America, and one from Asia.

Dis na how di pathway go be like:

Friday 27 March

  • Semi-final: New Caledonia 0 - 1 Jamaica
  • Semi-final: Bolivia 2 - 1 Suriname

Tuesday 31 March - Intercontinental finals

  • Jamaica vs DR Congo
  • Bolivia vs Iraq

Di winner of dis game between Jamaica and DR Congo go face Portugal, Colombia and Uzbekistan for Group K for di World Cup.

Di winner of dis game between Bolivia and Iraq go enta di tight group wit France, Senegal and Norway for Group I.

World Cup qualifying - European Play-offs semi-finals results

  • Turkey 1 - 0 Romania
  • Czech Republic 2 - 2 Republic of Ireland (Czech win on penalty)
  • Denmark 4 - 0 North Macedonia
  • Italy 2 - 0 Northern Ireland
  • Poland 2 - 1 Albania
  • Slovakia 3 - 4 Kosovo
  • Ukraine 1 - 3 Sweden
  • Wales 1 - 1 Bosnia-Herzegovina (Bosnia win on penalty)