You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Basketmouth announce separation from im wife, Elsie Okpocha
Nigeria comedian Basketmouth don announce say im don separate from im wife.
Di comedian wey im real name na Bright Okpocha post for im instagram page wia e say 'afta much deliberation, my wife and I don make di difficult decision to end our marriage.
Di comedian wey ask for privacy at dis time, dem two go continue to work togeda to give dia beautiful children all di care , love, guidance and support dem need.
'As much as e pain me to bring my personal life to di public space, dis na unavoidable situation', e tok.
Dem two bin don dey togeda for 12 years. Elsie confam dia eight years anniversary for one Instagram post for 2018.
Basketmouth and Elsie Okpocha bin welcome dia third child togeda for July 2021.
Wetin to know about Basketmouth and Elsie
Bright Okpocha wey dey popular for im stage name Basketmouth na Nigerian comedian and actor.
Im dey organize popular stand-up comedy concerts like Basketmouth Uncensored across di globe.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem born am for Lagos State but im come Abia State.
E complete im primary and secondary school for Apapa, Lagos and go University of Benin, Edo State to study degree for Sociology and Anthropology.
Elsie Opkocha na realtor and entrepreneur.
Im and Bright get three children togeda.
How Nigerians react
Many social media users dey in shock afta di ogbonge comedian announce say im and im wife don decide to end dia marriage.
'Di devil really dey fight so hard for di institution of marriage', one Twitter user tok
Anoda Twitter user ask how e go dey possible for dem to take care of dia children now wey dem dey go dia separate ways.
Oda celebrity marriage crash wey shake Nigerians
Funke Akindele and JJC Skillz
Nigerian actress, Funke Akindele husband announce dia separation for June 2022.
For one Instagram post, JJC Skillz say im and Funke decide to go dia separate ways.
“While e last we share a lot of things together and don create two beautiful children
"E tok say di last two years don dey extremely difficult for both of dem. JJC Skillz say dia relationship don dey beyond repair now. "I sabi say I don try my best to fix things but I believe e dey beyond repair now", e tok.
Im add am say three months before dat time, Funke bin insist say make im move out of di house and apart from di popular AMVCA awards im neva dey able to sit down in an 'amicable manner'
"I dey make dis announcement so di public go dey clear say both of dem dey pursue dia separate lives. Funke and JJC Skillz bin marry for 2016 and dia marriage suppose enta six years for 2022.
Meanwhile, di 'Jenifer Diaries' star neva comment on di mata.
Korra Obidi and Justin Dean
Nigerian dancer Korra Obidi trend for March 2022 afta one post wey her husband Justin Dean do wey e say im wan divorce im wife of four years.
Di couple bin marry for December 2017 and get two pikin, June and Athena.
Di tori bin comot just one week afta she born dia second child, Athena.
At first pipo bin tink say di mata na joke on top say e even dey dia during di delivery of dia last pikin wey dem do for house.
But e come write for Instagram story say no be joke.
For di post wey im put and later delete, e tok say: "Korra Obidi and I dey divorce. E don dey over! Pesin no go treat me like dis again.
I bin do my absolute best to make am work".
E add say "I bin no want dis, I bin do my best. My heart don break. I bin support her, I bin love her. I no deserve di way I bin dey treated." E tok.
Korra later confam dia divorce.
Gideon Okeke and Chidera Uduezue
Nollywood actor Gideon Okeke confam say im marriage of four years to Chidera Uduezue end for October 2022.
Di couple do dia white wedding for 21 April 2019.
Im break di news on im Instagram story afta plenty rumor say dem don separate for ova one year.
Im write say: “Na in di interest of clarity and clear conscience e become important. But yea… Breakfast reach Me too. Las Las”.
E later ask im fans to keep im and im ex-wife for dia prayers.