You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Two pilots kpai and major New York airport close afta plane hit fire truck
Two pilots don die afta one passenger plane jam one fire truck for LaGuardia Airport for New York.
Fotos from di scene show as di plane backwards and di cockpit almost comot for di bodi.
Debris, wreckage and warped metal full di bodi of di fire truck wey stand near am.
Authorities tok say dem don carry 41 pipo go hospital, dem later discharge 31 passengers but some suffer from serious injuries.
Wetin happun
At around 23:40 local time on Sunday, shortly afta Air Canada flight AC8646 land from Montreal, e jam one firefighting vehicle for di tarmac for LaGuardia Airport.
Dem bin call di truck minutes earlier to one separate incident wey happun on board anoda plane wey report "issue wit odour", according to Port Authority executive director Kathryn Garcia.
Afta di collision happun, authorities "immediately respond", Garcia tok.
Dem don begin investigation to determine wetin happun.
Investigators from di National Transportation Safety Board (NTSB) go dey look di speed wey di plane take dey waka, di staffing of di air traffic control tower at di time, and if anybodi dey ejected from di aircraft, according to Garcia.
Who be di victims?
Di aircraft – one CRJ 900 model – bin dey carry 72 passengers and four crew members.
Authorities neva make public di identities of di two pilots wey die.
Garcia tok say dem don account for all oda pipo wey dey on board di plane, and add say di sergeant and police officer wey dey inside di firefighting vehicle dey stable condition for hospital "wit no life-threatening injuries".
"I visit dem for hospital, and dem dey able to speak and we don notify dia families," Garcia tok.
Mayor of New York City Zohran Mamdani say "dem don brief am on di tragic collision".
"I dey grateful to our first responders, wey dia swift actions bin save lives," e tok.
E add say di NTSB "dey investigate di incident, and di City dey in close contact wit federal, state, and local partners".
New York Govnor Kathy Hochul call di incident "heartbreaking".
She add: "Our thoughts dey wit di victims, dia families, and evrione wey dey affected."
How travel go dey affected?
LaGuardia Airport na one of di busiest airports for US, ova 32 million passengers don pass through am in di last 12 months.
Currently e dey closed, and di earliest dem fit reopen am na 14:00 ET (18:00 GMT) on Monday, authorities tok.
Dem don cancel majority of flights wey dey listed on dia website on Monday morning, and dem delay some.
Hundreds of flights dey affected, wit carriers wey include American Airlines, Delta Air Lines, Southwest Airlines, United Airlines, and Air Canada.
Earlier, LaGuardia Airport authorities bin release one statement wey say "dem immediately activate emergency response protocols" afta di crash, di agency chairman and executive director bin dey di scene wit Port Authority police.
New York City Police Department say make pipo "expect delays and avoid di area if possible".
"Sake of one emergency incident for LaGuardia Airport, all streets and highway exits into di airport dey closed until further notice."
New York City Fire Department tell pipo to "expect cancellations, road closures, traffic delays and emergency personnel near LaGuardia Airport".
"Use alternate routes," dem post on X.