You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Why sun wan finish pipo for Nigeria - Expert
- Author, Ogechi Obidiebube
- Role, BBC News Pidgin, Lagos
- Read am in 2 mins
Nigerian Geologist, Dr Adepelumi Abraham say na serious heat wave Nigeria dey experience.
"For di part of di world wey we dey, di maximum temperature no suppose dey pass 30 degrees, anytin wey high pass dat no dey normal", Dr Abraham tell BBC Pidgin.
Since di beginning of 2019, di temperature dey hit around 35-38 degrees Celsius for some parts of di Nigeria.
Dr Abraham say di main tin wey dey cause hot weda na sake of say di ozone layer wey suppose dey protect pipo don reduce well-well so direct sun rays wey dey harmful dey enta di earth.
Di sun bad sotay some Nigerians for social media don write letter give di sun make e pity dem.
For odas, di sun fit even hot pass hell fire
Wetin pipo fit do?
Dr Abraham say di climate condition reach to get sleepless night on top but e get some tins wey kontri pipo fit do to reduce bad environmental situation for di kontri.
1. No dey burn doti anyhow
Di Geologist warn say make pipo stop to burn doti anyhow for dia domot becos di smoke go yamayama evriwia. Di sabi pesin say e dey be am like make im dey cry wen im see pipo dey burn dia doti anyhow.
End of Di one wey oda users dey read well well
2. Regulate factories
Smoke and gas wey dey from factories comot na one of di major factors wey dey contribute to di poor climate conditions for Nigeria. Dr Abraham say dis one na becos goment no dey regulate di method wey most factories dey use comot smoke.
3. No drive car wey no good
Sabi pesin oga Abraham advise say before pipo drive dia car enta road, make dem check weda di engine and exhaust dey okay so dat e no go dey bring out smoke.
Im dey predict say in di next 30 days, di hot weda go reduce and rain go begin fall.