Di Independent National Electoral Commission (Inec) don
record a case of vote disruption for di Osun state govnorship election.
Di incident happun for Polling unit 11, ward 7 for
Kajola, Atakumosa West Local goment area of Osun state.
Tori be say some armed men bin come arrest some pipo for
di polling unit for Atakumosa LGA of di state.
One eyewitness tell BBC Pidgin say di men wey wia uniform of one of di security agencies for Nigeria just pick up di men without explanation.
"We no know wia dem carry dem go," di eyewitness tok.
Di incident lead to argument between voters and political party agents wey later turn violent.
"Dem beat di police officer wey dey di polling unit as e dey try to resolve di mata. Na di dragging make dem break di ballot box.
"Dis na why di police officer call for reinforcement wey make di DPO come," anoda eyewitness tok.
Di Resident electoral commissioner of Inec for Osun state, Prof Abdulganiyu Raji visit Kajola to also know wetin happun.
Police DPO for Kajola and di election monitoring team brief Inec oga on wetin happun - e later ask di community pipo wetin dem want.
While some say make Inec count di votes wey dem don already cast before di disruption, odas say make dem kontinu wit di voting.
Police decide to secure di ballot box wey don break as di pipo no fit agree on wetin to do.
Director-general of the National Youth Service Corps (NYSC), Mohammed Fada, wey visit di scene, secure di safety of di youth corps members wey dey di polling unit.
Di decision of Inec on wetin happun for Kajola neva dey known.