You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Presidential court dismiss petitions of Obi, Atiku & APM for lack of merit

All eyes dey di court of appeal as di presidential candidates of di PDP, LP and APM go know dia fate for di 2023 elections.

Live Coverage

Helen Oyibo, Victor Ezeama and Tamara Ebiwei

  1. Judgement day for di presidential election petition court

  2. Breaking, Court reject 10 out of di 13 witnesses LP present

    Court still dey continue wit ruling on Labour Party issues.

    Court say 10 out of di 13 witnesses Labour Party bring no get head.

    Court say one of dem na party member wey get interest and wey don contest election under LP before.

    Court reject 10 out of di 13 witnesses.

  3. Breaking, 'APC no fit question di validity of Peter Obi party membership - 'Court

    Court continue to rule on di issues for Peter Obi petition.

    Court further hold say di stand of proof of non compliance lie on di petitioner as im owe am as a duty to show di court wia im score highest votes wey dem suppose to use declare Labour party winner.

    Court say Labour Party fail to prove di allegation of over voting.

    Meanwhile on di issue of membership of a party, wey APC bin say Obi no be beta member of LP, di court rule say APC no go fit question di validity of Obi membership as only a party know dia members.

  4. Court rulings on issues wey Labour Party bring

    As Court start to read Peter Obi of Labour party judgement, dem start wit all di pleadings wey Peter Obi put before di court.

    For dia ruling on di issues Peter Obi raise, court say di petitioner fail to establish any evidence to support im claims say im score majority of valid votes for di Feb. 26 presidential election.

    Court hold say instead of di petitioners to mention specific polling units wia im claim say im get majority votes, im merely tender Forms EC8 from some States without mentioning specific polling units.

    Say Peter Obi instead rely on spread sheets and experts analysis evidence.

  5. #PEPTJudgement, #ObeyTheJudiciary, odas trend as Nigerians await judgement

    No doubt say all eyes dey on di Court of Appeal wey dey choo eye for di mata of di victory of Bola Tinubu for di 2023 presidential election.

    Di election wey dey closely contested between di candidates of di APC, Bola Tinubu, Labour Party, PDP, Atiku Abubakar and Labour Party Peter Obi na one wey generate big interest among Nigerians especially di youth wey bin don tire for di status quo.

    Dem use social media to sustain conversation around di election and dia preferred candidate - di youngest among di candidates Obi - before, during and after di election.

    As di Court of Appeal dey expected to deliver judgement on dat election, e no dey surprising say di mata na di top trending for di kontri today.

    Hastags like #ObeyTheJudiciary. #Technicalities, #PEPTJudgement and #IREV na just some of di hashtags wey dey trend for Elon Muxk X wey formerly dey known as Twitter as di mata dey go on.

  6. Court resume with Peter Obi petition,

    Court don resume sitting afta di 15 minutes break.

    Dem resume with Peter Obi of Labour Party petition afta dem conclude APM mata.

    Obi no showface for court but Julius Abure wey introduce imsef as National chairman of Labour Party dey represent dem

    One of di judges for di panel dey read di issues wey Peter Obi bring for im petition at di moment.

  7. Live from inside di Court of Appeal

    Follow di proceeding live from inside di Court of Appeal here.

  8. Wetin dey happun for UNILAG planned protest?

  9. More on how court dismiss all oda reliefs APM bin ask for,

    Di Presidential Election Petition Court don dismiss all di reliefs wey APM ask for.

    Dis na afta dem consider di evidence wey dem bring before di Appeal Court.

    Di chairman of di panel of five justices hold say dii entire grounds centre on di issue of alleged invalid nomination of Sen. Kassim Shettima.

    And afta dem consider all di paragraphs of di petition and di reply by di respondents, wetin happun be say being a serving senator of Borno central senatorial district, im nomination dat time as vice president bin amount to double nomination.

    But, dem say qualification on non-qualification of a candidate dey clearly stated for di constitution and Supreme Court don decide upon di issue plenti ttmes.

    No oda law fit contradict di constitution dem tok.

    Di petitioner from di oral and documentary evidence fail to establish any concrete reasons on why dem go grant im prayers.

    On di allegation of APC not conducting any primary election to nominate di Vice president, dme say di petitioner no correct as e dey within di constitutional power of di president to nominate im running mate and di position of di petitioner dey therefore discountenanced.

    Having resolved all di issues against di petitioner, di petition no get any merit, dem tok.

  10. Breaking, PEPC don resume wit Peter Obi petition

    Di Presidential Election Petition Court don resume afta dem take break for 15 minutes.

    Up next, na Peter Obi petition.

  11. Breaking, Di PEPC dey go on break

    Di Presidential Election Petition Court don march break for 15 minutes.

    Ds na afta dem resolve one of di issues on double nomination of Vice President Kasim Shettima.

    Dem dey go on break afta dem strike out di petition of di Allied Peoples Movement, APM for lack of merit, competence and abuse of court process.

    Wen dem comeback di oda judges for di panel go give dia on decisions on di issue.

  12. How we take reach here

    Na on di 1st of March Inec bin declare Tinubu as winner of di presidential election wey take place on 25 February.

    For di result wey Inec announce,Tinubu get 8,794,726 votes, Atiku wey come second get 6,984,520, while Obi get 6,101,533 and Rabiu Kwankwaso of di NNPP get 1,496,687.

    Di candidates of di APC, PDP and Labour Party bin dey neck and neck. Bola Tinubu win 12 states, Atiku Abubakar also win 12 states. Peter Obi too win 12 states including di FCT.

    To win di presidential election for Nigeria, a candidate go need to get di most votes and 25% of ballots cast for two-thirds of Nigeria 36 states to be declared as di winner.

    Prof Mahmood Yakubu, di chairman of di Independent National Electoral Commission (Inec) and di National Collation officer for di Presidential election announcesay Tinubu meet dat criteria and dey returned elected.

    Read more on how dem announce Tinubu victory here.

  13. Breaking, Court strike out issue of Shettima double nomination

    Di Presidential Election petition Court don strike out di petition of di Allied Peoples Movement for lack of merit and abuse of court process.

    Di court afta dem consider di grounds of di petition wey dwell on alleged invalid nomination of Senator Kashim Shettima as di vice president say di presidential petition court lack di jurisdiction to consider di mata sake of say na pre-election mata wey di petitioner suppose don settle for di Federal High court.

    Court add say di process of qualification of any candidate for any election dey inside di constitution particularly for section 131(1) so diafore, di petition wey APM bring dey incompetent.

    Di five-man panel of Judges don sit down and dem don begin address di issues wey di petitioners raise one by one.

  14. Meet di judges wey go decide Tinubu fate

    Di five-member panel wey chook eye for di presidential election petition begin dey sit for di Court of Appeal complex for Abuja on 8 May.

    But who be di five judges wey go deliver di judgement wey many pipo don dey anticipate today?

  15. Ogbonge APC politicians dey inside court,

    Top APC politicians also dey inside court.

    Vice President, Kashim Shettima, Kogi state Govnor, Yahaya Bello, Femi Gbajabiamila wey be current Chief of Staff to di president, Imo state Govnor, Hope Uzodinma show face for court.

    Odas na Festus Keyamo and Nuhu Ribadu.

  16. Fotos from di Court of Appeal, Security full ground,

    All major roads wey dey lead to di Court of Appeal for Abuja, Nigeria capital dey blocked.

    Security pipo put road block to make sure say security dey intact to make sure say jaguda pipo no come near.

    Nobody dey allowed to pass di roads wey lead to di court except you get accreditation tag.

    Even govnors, Vice President, Kashim Shettima and oda big politicians wear dia tags.

  17. Live from inside di court

    You fit follow di process from di court live here:

  18. Di judges don show

    Judges don show and don sit down.

    Meanwhile, di Presidential candidate of di Labour Party Peter Obi no showface for court but Julius Abure wey introduce imsef as di National Chairman of Labour Party dey represent Peter Peter and Labour Party.

    Vice President Kashim Shettima plus some APC govnors dey court already.

    APC national chairman, Abdullahi Ganduje sef dey court as representative for di party.

    APC govnors wey dey ground na Kogi, Nassarawa, Imo, Ekiti, Yobe and Bauchi states.

    Oda party members na Chief of staff to di President, Femi Gbajabiamila; National Security Adviser, Nuhu Ribudu; and Minister of Aviation, Festus Keyamo.

    Di Labour Party Chairman, Julius Abure, and Aisha Yesufu also dey present.

    For now oda parties to di case, Atiku Abubakar of di PDP and Peter Obi of di Labour Party neva show.

  19. Wetin don happun so far?

    Dis petitions dey challenge di declaration of President Bola Tinubu as winner of di 25 February presidential election wey happun across di kontri by di Independent National Electoral Commission, Inec.

    Dem allege say Inec no comply wit di Electoral Act.

    Di petitioners dey also allege say mago-mago dey for di election.

    Dem dey also argue say di issue of electronic transmission of results.

    Federal Capital Territory, FCT 25 percent votes wey winner suppose get.

    Di double nomination of Vice President Kashim Shettima. Plus oda issues di petitioners also raise.

    Di Court of Appeal Abuja on 1 August, 2023 bin reserve judgement for di petitions wey di petitioners carry come.

  20. Judgement day

    Tight security dey for Abuja, Nigeria capital and around di court of appeal wia di eyes of all Nigerians, Africans and di world dey as di presidential election tribunal go give judgement today, on di petitions of di presidential candidates of di Peoples Democratic Party, PDP, Labour Party, LP and Allied Peoples against di 2023 elections.

    Afta months of chooking eye inside di mata, di presidential election petition court say judgement don ready and na on Wednesday dem go give judgement.

    Di petitions na between Peter Gregory Obi and Anor VS Independent National Electoral Commission and three odas.