Wetin you need to know about environmental sanitation for Lagos wey dey return

Wia dis foto come from, Lagos State

Wetin we call dis foto, Di announcement for di renewal of Sanitation fist come for March wit di symbolic cleaning for Mushin-Agege Motor Road
Read am in 4 mins

Lagos state go start di monthly enviromental sanitation for di state again for di last weekend of April.

Dis na according to di Lagos State Commssioner of Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab wey download how di whole tin go take hold.

Di plan to restart di statewide cleaning bin dey announced a month earlier by di Lagos State govnor, Babjie Sanwo-Olu wen e go Mushin-Agege Road for March 14 wit di Lagos State Ministry of Environment.

E tok dat time say, "I dey happy to share say di exercise (environmental sanitation) go start again for Saturday, 25 April 2026 and go now hols evri last Saturday of evri month from 6:30am to 8:30 am (Nigerian time)."

Oga Sanwo-Olu come ginger Lagosians say make dem "comot, clean your yard, clear di drains for front of your house and troway doti sharparly."

Environmental sanitation dey come almost 10 years afta dem comot di monthly sanitation for Lagos.

Di News Agency of Nigeria bin report say di move to comot di exercise bin follow one court ruling from March 2015 wey call out di restiction of movement for di exercise from 7am to 10am say e dey unconstitutional and dey impede on pipo freedom of movement.

According to oga Wahab dia go be rewards for di cleanest Local Govment Area, Local Council Development Area and di cleanest street.

But e also warn say any pesin wey go against di Sanitation order go face di consequnences according to di Lagos State 2017 Environmental Protection Law.

All dis one dey happun as Lagos State tok say dem dey expect heavier rainfall for dis year rainy season.

How di Environmental Sanitation exercise go happun

Di Lagos State Environmental Sanitation go start from di 25th of April 2026 and go happun evri last Saturday of di month from 6.30 to 8:30am.

According to di Lagos minstry of Environment and Water Resources pipo responsiblilties on di day dey different.

Howeva di tasks for evri body na to make sure say di drainage for di area dey clear say doti no full inside.

Any yama-yama wey dey inside gutter suppoe dey packed and left for LAWMA and PSP make dem come carry am.

And if drainage work dey wey pass your power, tell am give local govment to come work am.

Howeva, evri one from tenant to landlords to businesses dem and even community leaders get individual work.

DI ministry arrange am so:

Tenants and Household members work

Participate for compound sanitation wey landlord arrange.

Clean your own house narrange am for di three categories bifor sanitation

No put doti for drains or gutters or empty lands or inside your neighbour property.

Arrange wit compound pipo to contribute for cleaning materials.

No be to use di time take do non sanition work like play ball

Landlords

Arrange compound sanitation plan so evri bodi go get dia cleaning work at least two days to sanitation

Make sure say drainage and gutter inside and around di compound dey fully cleared

Give compound pipo currect dustbins and place to drop dia doti inside compound.

To maintain soakaways so e no go leak go outside

Make sure say tenants and family members worj dat day.

Report illegal dumping give LAWMA.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Business owners

Dem dey responsible to clean dia side for di sanitation time

All di doti from business must dey readi for pickup by LAWMA by 8:30am.

Dis business must to get sanitation cordinator wey go arrange staff and faciltiy cleaning.

Businesses dem wey get hazardous or medical waste no fit use LAWMA and nist use LASEPA licensed conractors

Comunity Leaders

Arrange community cleaning for public spaces like bus stops, street pavement, etc.

Tell household for yard wen sanitation go happun and wetin be di rules two days in advance.

Arrange wit LAWMA district office at least five days in advanceto know wia and wen dem dey come collect doti.

Submit post sanitation compliance summary give Local Govment Sanitation Officer within two days.