Bayer Leverkusen draw wit Arsenal for dia Champions League round of 16 first leg

Arsenal player Kai Havertz

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kai Havertz no celebrate as e score against Bayer Levekusen im former club. Kai Hervertz find di bottom left corner as e play di penalty kick wey Arsenal use equalise
Read am in 7 mins

Arsenal keep am late before dem manage to score one goal against Bayer Leverkusen for di Uefa Champions League Round of 16 first leg match.

Di premier League leaders bin dey dominate play but German side Leverkusen no give dem chance especially for second half.

Bayer Leverkusen rush Arsenal immediately second half start as Robert Andrich find di net as im nod di ball from corner kick.

Afta di goal, Arsenal struggle to enta di game again, until dem get beta chance wen Bayer Leverkusen player foul Noni Madueke for di goal area.

Referee check VAR to confam say na penalty.

Kai Havertz score from di penalty kick as Arsenal draw Bayer Levekusen 1-1

On Tuesday 17 March Arsenal go host Bayer Leverkusen for di Emirate stadium.

So far aggregate na 1-1. See di match highlight.

Match highlights

Second Half

FULL TIME Bayer Leverkusen 1-1 Arsenal

90+3 YELLOW CARD for two Arsenal players.

90' Referee add three minutes

89' Bayer Leverkusen 1-1 Arsenal

89' GOALLLLLLL

Kai Havertz score for Arsenal, e play di shot afta some steps but e nearly miss am, im no celebrate afta e fire di ball to di bottom left corner against im former club.

88' Kai Havertz of Arsenal wan play di penalty kick

86' PENALTY for Arsenal afta Leverkusen player bring down Noni Madueke of Arsenal, afta VAR check di penalty stand.

82' SUBSTITUTION for Leverkusen as Jonas Hofmann and Ezequiél Fernandez replace Martin Terrier and Exequiel Palacios.

Arsenal bring Gabriel Jesus on for Eberechi Eze, wey don struggle to make impact for di game.

80' Arsenal get free-kick for dangerous area but Leverkusen clear am, Leverkusen suddenly get good chance to break out.

78' E don reach 30 minutes since Arsenal last attempt any effort on goal.

77' Arsenal lose possession just like dat, dem dey try collect di ball back as Christian Kofane set up Aleix Garcia, wey fire shot mile from di goal area. 18.

Mikel Arteta dey para from di Arsenal technical area.

74' SUBSTITUTION for Leverkusen, Malik Tillman don enta for Ibrahim Maza.

And Kai Havertz enter for Arsenal, as e replace Viktor Gyokeres.

71' Kai Havertz dey warm-up for di sideline to enta di game from Arsenal bench.

69' YELLOW CARD for Martín Zubimendi of Arsenal. Im win di ball wit im tackle wit Exequiel Palacios but di referee see am as foul as e give am card.

68' Leverkusen just dey carry Arsenal play small, dem just dey play short -shrot passes as dem hold di ball from left to right and dem dey also fling in cross wey di Gunners need to clear.

68' Leverkusen don get nine shots on target so far while Arsenal get only six so far.

67' Noni Madueke of Arsenal don dey make small impact as e enta for dis second half, e carry ball run enta Leverkusen goal area but im shot land for Leverkusen goalkeeper hand.

66' Bayer Leverkusen almost get Christian Kofane down for di left side but di Arsenal goalkeeper David Raya clear di threat up around 10 yards from di half-way line.

64' Bayer Leverkusen players just gada di ball o! dem no dey give Arsenal small chance at all. Arsenal still dey try to break dem down.

63' YELLOW CARD for Leverkusen as Exequiel Palacios foul Martín Zubimendi.

60' SUBSTITUTION for Arsenal. Noni Madueke don replace Bukayo Saka.

59' Declan Rice floats free-kick but Leverkusen defend di aerial ball well.

57' YELLOW CARD for Leverkusen as Gabriel Martinelli run pass di left and Ernest Poku bring am down, e collect yellow card.

53' Arsenal don begin enta di game again small-small for di first time since second half start.

51' Arsenal still dey surprise as di goal take happun. Dem dey struggle to take control of di game.

Dis goal wey Leverkusen score Arsenal na di only second time ever wey Arsenal dey allow dia opponent to score inside di first minute of di second half for major European game, Zlatan Ibrahimovic goal for Barcelona for March 2010 na di first one.

48' Beta opportunity neva come for di two sides since Leverkusen score and Arsenal still neva balance well.

Bayer Leverkusen 1-0 Arsenal

46' Bayer Leverkusen score as Andrich find di back of di net, dis na di first time Arsenal dey dey behind for dis season Champions league.

Di hosts open di scoring from corner kick. Martin Terrier force David Raya to tip over im header and from di resulting corner, Robert Andrich sneak in and nobody bin dey mark am e just nod di ball inside goal post.

46' GOALLLLLLLL

46' Few seconds into second half, Leverkusen get chance to go front as Ronaldo head ball but e use small tin cross di bar.

46' Second half don start

Bayer Leverkusen players celebrate goal against Arsenal

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Bayer Leverkusen celebrate gaol wey Robert Andrich score
Eberechi Eze of Arsenal hold ball for im leg and Bayer Leverkusen player dey follow am for back, anoda Arsenal player dey for di background.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Arsenal dey stroke di ball around veri nicely indeed even though di home fans neva get beta oppportunity to celebrate about since di match start.

First Half

Half Time Bayer Leverkusen 0-0 Arsenal

45+2 Leverkusen get throw -in but notin come as referee blow whistle for half -time.

45 +1 Leverkusen get chance to score but Arsenal goalkeeper catch di ball.

45' Referee add two minutes

45' Corner kick for Leverkusen, dem play am but Arsenal defence clear di ball.

44' Arsenal hold possession of di ball for di last two minutes as Rice dey try to find way enta Leverkusen defence nut Leverkusen player tiff di ball from in leg.

42' Arsenal and Leverkusen still dey find goal and na few minutes remain for first half to end.

38' Na one shot on target Arsenal don get so far.

35' Exequiel Palacios don make four tackles and win four duels so far - both di most of any player for di two side.

33' Leverkusen French winger Martin Terrier fall down and im dey hold im knee so di match bin stop small.

E give Arsenal boss Mikel Arteta opportunity to call Declan Rice and Martín Zubimendi and give dem some instructions.

30' Leverkusen 0-0 Arsenal

29' So far, di match be like say di two teams no wan gree for each oda as Leverkusen don dey hold ball well-well for Arsenal goal area.

25' Christian Kofane na di main man for Leverkusen, im dey give William Saliba and Gabriel Jesus of Arsenal plenty problems.

25' YELLOW CARD for Arsenal as Martinelli collect card afta e foul Leverkusen player, e pull Exequiel Palacios shirt.

24' Leverkusen goalkeeper Janis Blaswich no gree leave di ball afta Piero Hincapie fire beta shoot wit im right-foot

21' Arsenal defender Gabriel fall for ground afta e blocking Jarell Quansah shot wit im upper body.

19' Really good work from most of di Arsenal frontline before Martinelli hit di bar! Di ball for enta net.

15' Ibrahim Maza break wit beta run, im get di ball back from Christian Kofane for Leverkusen. Di Algeria forward move small yard but im shoot di ball go up well over from 18 yards.

14' Christian Kofane tiff di ball from Gabriel but Declan Rice wey dey im back cover for Arsenal.

14'Arsenal still get control of di ball for di midfield wit short short passes but Leverkusen intercept di ball to get possession.

11' Arsenal collect di ball from Leverkusen as dem kontinu attack but di ball go out of play.

9' Both Arsenal and Levwerkusen dey wrestle wit di ball for midfield.

7' Beta football from Leverkusen but e end wit Christian Kofane shot wey land for Arsenal goalkeeper David Raya hand from 20 yards.

6' Bayer Leverkusen defender Robert Andrich dey playing dangerous game as im concede free-kick sake of body checking, referee don warn Viktor Gyokeres

2' Referee just flag Bukayo Saka for offside afta just 20 seconds as e be like say Arsenal dey put Leverkusen under pressure.

Saka dey make im 25th appearance for di Champions League dis evening and na one of only 13 players to get 20+ goals/assists combined for dia first 25 games (12 goals, 8 assists).

1' Referee blow whistle, match don start.

Kasper Hjulmand wey be Bayer Leverkusen coach wear black winter jacket, e face front wit im finger wey dey like say e dey point sometin. Arsenal coach Mikel Arteta wear black winter jacket, e dey smile as e face sideways dey look camera, e be like say e dey clap im hands.

Wia dis foto come from, INA FASSBENDER / AFP via Getty Images/Ryan Pierse/Getty Images

Wetin we call dis foto, Bayer Leverkusen coach, Kasper Hjulmand/ Arsenal coach, Mikel Arteta