Police arrest Singer D4vd on suspicion say e murder teenage girl

Wia dis foto come from, Getty Images
Police don arrest US singer D4vd on top suspicion say e murder one teenage girl wey miss last year.
Di TikTok star, wey im legal name na David Anthony Burke na di target of one grand jury investigation into di clear murder of Celeste Rivas Hernandez, wey dem find her deadi body for inside im Tesla for September.
Di Los Angeles Police Department tok say dem hold di 21-year-old without bail and dem go present di case to di District Attorney office on Monday.
Di singer dey silent on top di mata but im representatives tok say e dey cooperate wit authorities.
BBC don contact im representatives about di arrest.

Wia dis foto come from, Getty Images
Police on Thursday say dem arrest Burke "for di murder of Celeste Rivas".
Questions don dey mount since dem discover di body of di 14-year-old on 8 September for one Hollywood tow yard afta authorities receive reports say one bad odour dey come from di vehicle.
On 8 September 2025, investigators see her decomposed head and torso for inside one cadaver bag for di front boot of one Tesla car wey dey registered to D4vd address for Texas, court documents tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di county medical examiner say di body dey "severely decomposed" and e postpone on making a ruling on how she die pending di death investigation. Di girl fit don die "for several weeks" bifor dem discover her body, officials tok.
Authorities neva announce di cause of death for di teen case, as dem say for months, dem dey treat di case as death investigation.
One judge bin order say make di teen death records dey sealed to ensure say officers receive information from di medical examiner bifor di public.
Rivas Hernandez – wey dey live about 75 miles (120km) away from wia dem discover her body – bin dey reported missing by her family for April 2024, but dat no be di first time she go run away from dia Lake Elsinore home.
A first-generation daughter of immigrant parents from El Salvador, neighbours recognise her as a girl wey dey visit di corner store almost daily to buy candy and soda, according to di Los Angeles Times.
Di lack of information for di horrific death don ginger conspiracy and online conversation as many pipo dey reason di girl connection to di Romantic Homicide singer.
One grand jury begin dey hear di evidence for di case for December, but D4vd arrest on Thursday mark di first significant development for di case in months.
More details about di case bin come out for court filings afta One California court summon di singer family to testify bifor di grand jury.
Wen Dawud Burke, D4vd father, fight against di summons for one Texas court, e include material from di California case wey bin no dey available to di public bifor.
Di filings wey BBC obtain confam say D4vd don dey identified as "target" of a grand jury investigation for Los Angeles and e fit dey subject to proceedings for one count of murder.

Wia dis foto come from, Getty Images
Few details wey dem share wit di public bifor include say Rivas Hernandez bin dey wear one tube top, small size black leggings and jewellery, including one yellow metal stud earring plus one yellow metal chain bracelet, wen dem see her body.
She also get tattoo wey read "Shhh…" for her index finger - one mark wey nearly dey identical to di one wey dey di singer index finger.
Shortly afta dem see di body, di 'Here With Me singer' cancel im world tour, wey signal di beginning of di end of im pop career and im retreat from di spotlight.
Los Angeles police bin tok bifor say dem raid di Hollywood Hills mansion wia e dey live, just blocks from wia dem tow im Tesla.
E also dey dropped from marketing campaigns wit US retailer Hollister and footwear giant Crocs.
Telepatía singer Kali Uchis also announce say dem dey take down dia collaboration, Crashing.













