Tinubu go visit Jos, police gbab suspects and oda tins wey don happun since deadly Plateau attacks

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency

Read am in 4 mins

Nigeria President Bola Tinubu dey go Jos, di Plateau State capital on Thursday 2 April to commiserate wit di families of pipo wey lose dia lives for di attacks wey happun on Palm Sunday and Wednesday 1 April.

President Tinubu give di informate on im X account on Wednesday 1 April.

"I go dey for Jos to commiserate wit families wey don lose loved ones and to reaffirm say dose wey seek to spread fear no go prevail. We go continue to strengthen our security response and ensure say justice dey done," e tok.

E say from Plateau, im go "proceed to Lagos to observe Good Friday, and den continue wit scheduled engagements for Ogun, Lagos, and Bayelsa focused on infrastructure, trade, and economic growth".

Di deadly attack wey happun on Sunday 29 March for di Gari Ya Waye community of Angwan Rukuba kpai ova 20 pipo and injure several odas.

Di Commissioner for Information and Communication, Rt Hon Joyce Lohya Ramnap, say di govment condemn di "barbaric and unprovoked attack on innocent citizens".

Di Plateau State Govment bin impose 48 hours curfew on Jos North Local Govment Area afta di deadly attack for di Gari Ya Waye community of Angwan Rukuba.

Rt Hon Joyce Lohya Ramnap wey be di Commissioner for Information and Communication, say di govment condemn di "barbaric and unprovoked attack on innocent citizens".

Di curfew bin take effect from Sunday midnight and last till Wednesday 1 April.

Afta di end of di curfew, anoda violence happun on Wednesday for some areas for Jos metropolis as local tori pipo say at least one pesin bin kpai and panic spread for several neighbourhoods for Jos North.

"In moments of grief, we gatz stand togeda. In moments of progress, we gatz keep building. Di work continue. Nigeria First," President Tinubu tok for im tweet on X.

Tinubu receive Plateau State govnor for Presidential Villa, police arrest suspects

Wia dis foto come from, @aonanuga1956/X

Bifor im announcement say im go visit Plateau State, President Tinubu on Wednesday bin receive di state Govnor Caleb Mutfwang, for di Presidential Villa for Abuja.

Di meeting bin focus on immediate security measures to prevent further attacks for Plateau State.

On Wednesday, di Plateau State Command of di Nigeria Police Force confam say dem gbab one suspected fake soldier and five odas in connection wit di tension wey rock parts of Jos on dat day.

Di Police Public Relations Officer, Alfred Alabo, say di suspect, wey bin wear army singlet and one extra shirt, chop arrest for Angwan Rukuba, di same community wia several pipo kpai and injure on Palm Sunday.

E say dem gbab di suspect as e dey roam suspiciously for di area on Wednesday afternoon and dem find fake Nigerian Military School (NMS) identity card for im hand.

Alabo describe di five odas wey dem gbab as hoodlums wey bin exploit di situation to engage in criminal acts.

Unijos order emergency evacuation of students

Di management of di University of Jos on Wednesday direct dia students to vacate dia hostels sake of security concerns for parts of Jos.

Tanko Ishaya wey be di Vice Chancellor order di immediate evacuation of students from hostels as precautionary measure.

Na di Deputy Registrar, Information and Public Relations, Emmanuel Madugu, give di informate inside one statement.

"Di Vice Chancellor don direct di immediate evacuation of students from di university hostels in view of di general security situation and di near chaotic scenarios witnessed in areas wey dey close to di university," di statement tok.