Manchester City 1-1 Arsenal live updates
Wia dis foto come from, Getty Images
First Half
18’ GOALLLLLLLLL for Arsenal! Gianluigi Donnaruma make mistake, Kai Havertz pursue di ball, e later get di ball and fire am insode di net.
16’ GOALLLLLLLL! for Manchester City!
Rayan Cherki bin dey clear di header from far and di ball fall outside di box’ im dribble in way pass di defence and shoot di ball into di far corner!
15’ Manchester City defender clear di threat from Arsenal as Mosquera bin wan fire shot near di goal area.
12’ Goal kick for Manchester City wey dey try to break Arsenal defence but di Gunners no dey give dem space.
10’ Corner kick for Arsenal afta ManChester City play foul Odegaard, e play am but City defenders clear di threat.
8’ Arsenal still dey try to settle down for do game but Doku collect di ball from Arsenal leg e run enta Arsenal goal area, e give di ball to Semenyo wey kivk am out of play.
4’ Declan Rice save Arsenal as e save Antoine Semenyo for di right side of di box, e stop di corner kick wey suppose hapun.
End of Di one wey oda users dey read well well
4’ Only about four minutes into di match and Manchester City dey worry Arsenal defensive.
3’ Manchester City start dis match wit beta ginger as dem begin wit early tackles, dem no dey allow aArsenal settle down wit di ball.
1’ Match don start
Line up
Manchester City starting 11: Donnarumma, Nunes, Khusanov, Guéhi, O'Reilly, Rodri, Bernardo, Semenyo, Cherki, Doku, Haaland
Arsenal starting 11: Raya, Mosquera, Saliba, Gabriel, Hincapie, Rice, Zubimendi, Eze, Odegaard, Madueke, Havertz
Manchester City and Arsenal go face each oda on Sunday for di 2026 Premier League season match.
Na for di Etihad stadium wey be Manchester City home ground na im dis ogbonge match go hapun.
Di match go totori football fans as dem go see di tactics, style of play of two ogbonge coaches Pep Guardiola and Mikel Arteta.
Some football fans say na di battle of di coaches while odas say na players for field go control di game.
Manchester City manager Pep Guardiola bin tok ahead of dis match say di race is "over" wit six games to play if dem lose to Arsenal on Sunday but "many tins still dey to do".
Arsenal manager Mikel Arteta bin tok say im want make im team play with 'pure fire' as dem bin dey prepare for dis important week, as dem go visit dia closest challengers Manchester City on Sunday for di Premier League.
Arsenal dey first position for di table while Manchester City na second and dis two clubs no wan give each oda breathing space.
Evritin dey at stake for di big game sake of say Arsenal dey hope to win di Premier League title dis season but Manchester City dey pursue dem back to back.
Arsenal currently dey top di Premier League table wit 70 points afta 32 matches while Manchester City dey second place wit 64 points afta 31 matches.
E mean say if Arsenal win dis match dem go move to 73 points afta 33 matches and dem go get small space to breathe as dem dey chase di title.
For di oda side, if Manchester City win dem go close di gap wey dey between dem and Arsenal wit three points and if dem also win dia outstanding match dem go dey on equal points wit Arsenal.
Afta dis match on Sunday, na five matches go remain for Arsenal to play and dem get 15 points to grab if dem win all dia matches.
Manchester City get six matches to play if dem win all dem go get 19 points .
E mean say on di final match both Manchester City and Arsenal go tie on di same points and na goal difference dem fit use decide who go be champion dis season.
Head to head
Even for di stats dis season, Manchester City dey pursue Arsenal back to back
Manchester City get 63 goals while Arsenal score 62 goals for all competitions but for di Premier League dis season Arsenal get 38 goals while Manc City get 35 goals. As e be so, evri goal dey important.
Arsenal and City don play a total of 196 matches for all competitions. City win 58 while Arsenal win 96. Dem play draw 46 times.
Recently, for di League Cup final last month, Arsenal lose 0-2 to Manchester City.
For dia meeting dis season for September, 2025 Arsenal and Manchester City play 1-1 draw but Arsenal sama Manchester City 5-1 for February 2025.
Manchester City dey unbeaten for dia last 10 Premier League home matches against Arsenal since dia 2-0 loss for 2015 under for coach Manuel Pellegrini.
Arsenal dey unbeaten for dia last five Premier League matches against Manchester City, but dem bin lose 12 against dem in a row.
City dey unbeaten for dia last Premier League home matches since dem lose 2-0 against Tottenham for dia opening match dis season.
Arsenal lose dia last three domestic matches wey be di League Cup final against City, Southampton for di FA CUP and Bournemouth for di Premier League.
Top Tori
Informate me
Di one wey dem dey read well well
Content is not available