Pope Leo XIV to hold giant mass for Cameroon, plus oda highlights of im visit to di kontri

Wia dis foto come from, Michel Mvondo / BBC

Wetin we call dis foto, Joyful crowds bin turn out to welcome di Pope as e deliver im message of peace to areas wey separatist insurgency don scata
Read am in 6 mins

Pope Leo XIV dey expected to hold one giant mass today Friday, 17 April for Cameroon economic capital Douala, and more dan one million pipo dey expected to attend di service.

Thousands of Catholics don dey find dia way to di city ahead of di service, wey go hold for di stadium.

Di mass na central moment of di Pope 11-day of Africa, wey don see am visit Algeria bifor e land Cameroon.

Leo go travel go Angola and Equatorial Guinea afta today service. E dey use dis im tour to call for peace and reconciliation.

Dis na highlights of Pope Leo XIV journey to Bamenda

Pope blast foreigners wey dey exploit Africa

During im 3-day visit to one conflict-hit region of Cameroon, Pope Leo XIV bin lambast foreigners wey dey exploit di wealth of Africa for profit .

For inside one of im plenty comments wey e make for di Central African kontri, e blast dos wey dey spend billions on wars and e tell Cameroon govment to root out corruption for peace to prevail.

E bin spend di day for Bamenda, one city wey dey di centre of Cameroon brutal and long-running separatist rebellion.

Na outsides dey put fire for internal problems "in di name of profit, to continue to dey exploit and plunder di African continent", e tell one estimated 20,000 worshippers during one Mass for Bamenda Airport.

"Na one handful of tyrants dey dabaru di world," e tell di pipo wey gada - im comments bin come afta US President Donald Trump recent criticism of di pontiff, wey bicom di first US-born Pope last year.

"Dos wey dey rob your land of dia resources dey generally invest most of di profit for inside weapons, and dem dey continue to carry endless cycle of destabilisation and death," di 70-year-old Pope tok.

Pope meet wit religious leaders and victims of di Anglophone conflict

Wia dis foto come from, Michel Mvondo / BBC

Wetin we call dis foto, Pipo siddon outside to discuss di crisis for di North-West and South-West regions

For one peace meeting for Bamenda wey hold for Saint Joseph Cathedral, di about y 10-year insurgency for Cameroon two English-speaking regions don leave at least 6,000 pipo dead and many more dey forced to run comot dia homes.

Religious leaders and victims of di Anglophone conflict bin take turns to share di impact of di fight-fight wey dey happun for di kontri wit di Pope.

One Muslim leader tok how dem dey kill members of di Mbororo indigenous community, and dem dey loot dia cattle plus oda items.

One reverend sister share details of how separatist fighters kidnap her as she highlight di seriousness of di conflict.

Anoda man tok how e dey force forced to leave im house.

Di Pope hail dia work and say na model for di whole world: "Make we thank God say dis crisis no degenerate to religious war."

Commentators say di Pope dey unusually blunt for im speeches for Cameroon.

Na since 2017, dos wey wan create breakaway state for Cameroon Anglophone region don dey fight govment forces.

Dem dey para sake of wetin dem see as di marginalisation of Cameroon English-speaking minority by di Francophone-dominated govment.

Pope meet wit Cameroon President Paul Biya

Wia dis foto come from, EPA/Shutterstock

Wetin we call dis foto, Paul Biya, di world oldest head of state, greet Pope Leo for Yaoundé bifor di pontiff move to Bamenda

Pope Leo on Wednesday bin meet wit President Paul Biya for di presidential palace for di capital, Yaoundé, wia e give pointed advice to di govment.

"In order for peace and justice to prevail, di chains of corruption - wey dey disfigure authority and strip it of dia credibility - must dey broken," e tok.

"Hearts must dey set free from an idolatrous thirst for profit," di pontiff tok as di world oldest head of state just siddon dey look witout emotion.

During di same address, Pope Leo urge Cameroonian authorities to integrate di voices of women, youth, and di civil society in decision-making processes, underscoring dia vital role in nation building.

Di pontiff describe young pipo as di hope of Cameroon and di Church.

"Dia energy and creativity dey invaluable. Investing in dia education, training, and entrepreneurship dey essential for peace and for preventing di loss of talent and di spread of social ills," e tok.

Pope Leo bin also address di kontri worrying security situation wey don claim lives, disrupt schooling, and displace families. E re-echo im previous message against wars, as e say "make peace no dey reduced to slogan."

Additionally, e caution against corruption, lack of transparency, and call for respect for human rights.

Afta di meeting for di Presidential Palace, di Holy Father visit one orphanage and later meet wit Bishops.

Pope Leo hold giant mass for Douala

Pope Leo don urge Cameroonian youth to shun abuse and violence, as e encourage dem to diversify their talents and support dia communities.

For one mass, wey tens of thousands attend for di economic capital Douala, Pope Leo bin focus im message more on spiritual matters pass social-political criticism wey mark di early days of im visit to di Central African nation.

However, e note di contrast for di lives of Cameroonians wey e say dey blessed wit natural resources but dey drowned in material and spiritual poverty.

"Reject every form of abuse or violence, wey dey deceive by promising easy gains but dey harden di heart and make am insensitive," di pontiff tell young pipo.

Ahead of Friday grand mass, several pipo bin spend di night outside di Japoma stadium premises to participate for di papal ceremony.

Peace na di main theme of di Pope 11-day tour of di continent, wit Angola and Equatorial Guinea next on im agenda.

E start im trip for Algeria on Monday, wey mark di first time any pope go visit di predominantly Muslim kontri.

During im two days for Algeria, e bin go di Great Mosque for Algiers.

"I think di visit to di mosque dey significant and to say dat although we get different beliefs, we get different ways of worshiping, we get different ways of living, we fit live together in peace," e tok afterwards.