Pictures: Hurricane Irma jam Florida

Photos from Florida as "monster" Hurricane Irma land for di city.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Satellite photo on Monday morning show storm Irma as e dey over Florida while another storm- Jose dey for water.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dem give people where to stay for Germain Arena for Estero, Florida.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dis man dey waka for street wey flood for Miami don cover on Sunday.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Crane wey dem dey use for construction for Miami collapse.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di storm blow roof of houses comot for Miami.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Dis petrol station really hear am for Irma hand.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, House wey fit move for Bonita Spring full with flood.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, People wey dey live for Tampa dey take picture of Hillsborough bay before Hurricane Irma bin land.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Trees and one thing pikin dey use play as breeze just blow dem scatter.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One place wey dem dey keep boat for Hollywood, Florida as breeze take scatter am.

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Dis petrol station for Biscayne Boulevard feel Irma force well-well.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Some part of Miami bin receive di full force of Hurricane Irma.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di National Guard help remove some people from hospitals wey dey Lower Keys area.