Photo: Big flood don land for Houston

Dis na Pictures from the fourth largest city for US wey dey battle with big flood.

Wia dis foto come from, AFP/Getty

Wetin we call dis foto, Water dey deep for some place for Houston sotey e dey almost reach billboard

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Flood water don full many of di road wey dey for di city

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Dem don set up place wia people fit stay including for one convention centre

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Officials dey expect 30,000 wey go stay for emergency house

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Many motor just dey inside water across di city. Rescue workers even free di people wey drive dem.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Coastguard follow dey rescue people wey no get wia to go.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Helicopter jack people up from ground to carry dem comot

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, For many people wetin just dey dem mind na to rescue dem pet before property

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Emergency 911 people for Houston receive 56,000 calls over 15 hours- seven times more than wetin dem dey receive for normal day.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Picture from up dey show tall-tall buildings wey water don cover for Houston

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, One woman and her dog dey wait for help on top one airbed wey dey float

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, For tori conference, di Federal Emergency Management Agency tell ordinary citizens to "get involved" for di rescue effort