Bola Tinubu inauguration: Pictures of how Tinubu swearing in ceremony happun

African leaders along wit religious leaders, traditional rulers and oda important pipo follow witness di event for Eagles Square Abuja.

Wetin we call dis foto, Security officials release di Nigerian flag, wey symbolise a change in goment
Wetin we call dis foto, Di Eagle Square, one big space for Abuja, di kontri capital, wia dem dey use for swearing-in. Decorated wit White and Green, colours of di kontri, dis venue don witness di inauguration of ova four presidents of Nigeria since dem construct am for 1999
Wetin we call dis foto, Dancers dey on display to showcase di richness in Nigeria culture
Wetin we call dis foto, Police parade for Eagles Square, Abuja as dem swear in di new Commander-in-Chief of di Armed Forces
Wetin we call dis foto, Dem swear-in Bola Tinubu as di new president of Nigeria for one ceremony for Abuja Eagle Square on May 29, to cheers from di crowd. Di 71-year-old win di February election as im defeat 17 oda candidates wey participate for di election. E score a total of 8,794,726 votes, wey mke am di candidate wit di highest vote.
Wetin we call dis foto, Ghana president Nana Akufo Addo (Second from right) join di plenti African presidents and oda foreign dignitaries to attend di inauguration of Bola Tinubu as di 16th leader of di continent most populous nation. One nine-member delegation from di US and Chinese officials led by one Communist Party senior member also show face for di event.
Wetin we call dis foto, Afta im don serve for eight years, now former president of Nigeria, Muhammadu Buhari hand ova power to im party man, Bola Tinubu. For im farewell speech, e describe di new president as di best candidate out of all di presidential candidates for di 2023 elections. Buhari go now retire to im house for Daura, Katsina state.
Wetin we call dis foto, Some young Nigerians cari placard to say Thank you to Muhammadu Buhai as e retire to im home for Daura
Wetin we call dis foto, Outgoing Vice President Yemi Osinbanjo hand ova to im successor, Kasim Shettima for di inauguration wey happun on Monday May 29 for di kontri capital, Abuja.
Wetin we call dis foto, Aisha Buhari wit her security aides for Eagle square, Abuja
Wetin we call dis foto, Traditional rulers dey in attendance for Tinubu inauguration ceremony
Wetin we call dis foto, Nigeria first family - President Bola Ahmed Tinubu alongside im wife, Remi and im son, Seyi
Wetin we call dis foto, "Our administration go only govern you but neva rule over you. We go consult and dialogue but neva dictate. We go reach out to all but neva pull down one single pesin sake of say e hold views wey dey contrary to our own." Tinubu tok as e take oath of office.
Wetin we call dis foto, Many challenges dey ahead of Nigeria new president. Inflation dey run at its highest rate for nearly 18 years, one in three pipo dey unemployed and di output of di oil industry wey dey important for di kontri economy dey shrink. E gatz move quickly to convince pipo wey no vote for am say im dey up to di task.