Nigeria election result 2023: Senators-elect list wey INEC release and di party wey gbab majority seat

Wia dis foto come from, Nigerian Senate
Di Independent National Electoral Commission (INEC) don release di list of senatorial-elect for di Nigeria election wey hold on Saturday 25, 2023.
Out of di 109 seat, 8 still dey vacant sake of death of one of di candidate and supplementary election wey go hold for seven constituencies.
APC win majority of di Senate wit 54 seat while di PDP gbab 33 seats, LP gbab 7 seats,
INEC Chairman, Mahmood Yakubu, for im remark during one meeting wit Resident Electoral Commissioner (RECs) for Abuja na say eight political parties produce lawmakers for di election.
Di parties na —di All Progressives Congress (APC), di Peoples Democratic Party (PDP), di All Progressives Grand Alliance (APGA), Social Democratic Party (SDP), Labour Party (LP), New Nigeria Peoples Party (NNPP) African Democratic Party (ADC) Young People Party (YPP).
According to Oga Yakubu, dem also don conclude election into 423 out of 469 national legislative seats.
INEC breakdown of di winners by state

Wia dis foto come from, INEC

Wia dis foto come from, INEC

Wia dis foto come from, INEC

Wia dis foto come from, INEC
Wetin dey ahead?
Di Senate na di upper chamber of Nigeria bicameral legislature, di National Assembly. Di National Assembly wey dem dey popularly refer to as NASS na di kontri highest legislature and e get di power to make laws.
Di 36 states of di kontri get three representatives each and di FCT wey be di kontri capital get one seat for di Senate.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis senator-elect go form di 10th national assembly afta inauguration wey go shele by June.
Wit 54 seats for di upper chamber, di ruling All Progressives Congress, APC don form di majority though e neva achieve am for di lower House. One party dey need 180 seats to form majority for di House.
Oga Yakubu say dem go hold supplementary elections for 46 constituencies to complete di National Assembly seats. Although im neva give dates for di exercise.
Di INEC boss say dem go present di senators-elect wit certificates of return on 7 March for di International Conference Centre for Abuja while di House of Representatives-elect go receive dia own on 8 March. for di same venue.
Di Commission bin declare di APC presidential candidate, Bola Tinubu, winner of the presidential election wey hold on di same day wit di National Assembly elections.
Di candidates of di PDP, Atiku Abubakar, come second while dat of di LP, Peter Obi, and NNPP Rabiu Kwankwaso, come third and fourth respectively.
INEC don since present Oga Tinubu and im running mate, Kashim Shettima, wit certificates of return even as di opposition don vow to challenge di process for court.
Nigeria election results 2023: Up-to-date results of presidential and parliamentary races
Nigerians cast their votes in Saturday’s general election. They had 18 candidates to choose from for president and people also voted for senators and members of the house of representatives. The BBC is using data provided by Nigeria’s Independent National Electoral Commission (Inec) to tally the results.
Nigeria presidential results 2023
To win in the first round, a candidate must have the largest number of votes nationwide and at least 25% of the votes in two-thirds of the 36 states and Federal Capital Territory (Abuja)
Last updated: 19/04/2023, 18:00:24 local time (GMT+1)
Final results
Nigeria presidential results 2023
To win in the first round, a candidate must have the largest number of votes nationwide and at least 25% of the votes in two-thirds of the 36 states and Federal Capital Territory (Abuja)
Last updated: 19/04/2023, 18:00:24 local time (GMT+1)
Final results
Presidential election results by state
Presidential election results by state
Last updated: 19/04/2023, 18:00:24 local time (GMT+1)
Click on map to see results in detail
Senate results by party
Last updated: 19/04/2023, 18:00:24 local time (GMT+1)
| Party | Seats |
|---|---|
| All Progressives Congress | 59 |
| Peoples Democratic Party | 36 |
| Labour Party | 8 |
| Others | 4 |
| New Nigeria Peoples Party | 2 |
House of Representatives results by party
Last updated: 19/04/2023, 18:00:24 local time (GMT+1)
| Party | Seats |
|---|---|
| All Progressives Congress | 159 |
| Peoples Democratic Party | 104 |
| Labour Party | 35 |
| New Nigeria Peoples Party | 18 |
| Others | 9 |
| Inconclusive | 35 |
Credits
Designers: Millicent Wachira and Olaniyi Adebimpe; Visual Artists: Mayowa Alabi and George Wafula: Data Journalists: Yusuf Akinpelu and Brian Osweta; Developers; Boaz Ochieng, Marcos Gurgel, Ayu Widyaningsih Idjajaand and David Ayoola; Project Lead: Dorothy Otieno.




Who is Rabiu Kwankwaso?
Who is Peter Obi of the Labour Party?
Who is Atiku Abubakar?
Who is Bola Tinubu of the APC?










