Nigeria presidential election 2023 Pictures: Atiku Abubakar, Bola Tinubu, Peter Obi and odas battle for historic vote

Di first leg of di 2023 General Elections for Nigeria dey happun for February 25 with di presidential and parliamentary elections.

Wetin we call dis foto, Inec deliver on dia promise of February 25 as di day for Nigeria presidential and parliamentary elections
Wetin we call dis foto, Many pipo come early enuf to carry out dia civic duty. Here some dey check dia names for di voters register
Wetin we call dis foto, Pesin dey vote inside cubicle for Lagos, Nigeria
Wetin we call dis foto, Plenti of di voters come super early although for many polling units e take time for INEC officials to take set up
Wetin we call dis foto, Pipo enta online to ginger pipo make dem stay until di setup dey complete. Lowkey, wia APC Presidential candidate Tinubu vote no quick open.
Wetin we call dis foto, Inec official hold ballot paper. Inec bin don give warning say BVAS dey mandatory for voting and without PVC you no fit vote
Wetin we call dis foto, Rivers State Govnor Nyesom WIke dey disappointed as so im no fit vote initially as di BVAS machine no work
Wetin we call dis foto, Kaduna state Govnor Nasir El-Rufai stand for queue to cast im vote.
Wetin we call dis foto, So far di three front runners for di presidential race; APC Bola Ahmed Tinubu, PDP Atiku Abubakar and LP Peter Obi don cast dia votes
Wetin we call dis foto, Reverend sisters dey wait to vote.
Wetin we call dis foto, Reports of late election and Inec officials wey no show make pipo para for Amuwo Odofin Lagos area of di kontri.
Wetin we call dis foto, Pipo para for Amuwo Odofin area for Lagos afta plenti hours wey dem dey wait for election materials to reach dia polling units
Wetin we call dis foto, Pipo dey para for polling unit for Amuwo Odofin
Wetin we call dis foto, Di tori wey dey comot from Amuwo Odofin be say BVAS machine just dey mess up dey go
Wetin we call dis foto, Police dey calm di kasala wey wan start sake of lack of voting
Wetin we call dis foto, But even with all the tension wey dis kain period dey bring fordi kontri, silver lining day, no traffic, as such major road networks dey turn football fields to take coole bodi for young pipo.