Nigeria presidential elections results 2023: Bola Tinubu win Peter Obi, Atiku Abubakar

Di National Chairman of Nigeria Independent National Electoral Commission (Inec), Prof. Mahmood Yakubu don declare APC candidate Bola Tinubu as winner of di 2023 presidential election afta e receive results from di 36 states of di federation and di FCT.
Millions of Nigerians vote for di most competitive presidential election since military rule end.
Dem also vote to elect lawmakers into di national assembly. 109 federal senators and 360 members of di house of representatives, and dat for govnors dey hold in March.
Since 1999, Africa most populous kontri don dey dominated by two parties - di ruling APC and di PDP.
But dis time, e also get a strong challenge from one third-party candidate - di Labour Party Peter Obi, wey dey backed by many young pipo.
Di election see huge interest from first-time voters and young pipo - one third of di 87 million eligible voters dey below 35 - pipo bin tink say e fit lead to high voter turn-out dan di 35% wey dem record for 2019.
To win, one candidate bin need to get di most votes and 25% of ballots cast for two-thirds of Nigeria 36 states to be declared as di winner
If no-one achieve am, e for enta run-off wey for happun within 21 days - if e happun, e for be first for Nigeria history.
End of Di one wey oda users dey read well well
Check out di results as Inec announce am LIVE
Nigeria election results 2023: Up-to-date results of presidential and parliamentary races
Nigeria general election happun on 25 February 2023. Eighteen candidates dey di race to be president and voters don cast ballots for senators and house of representative members. BBC use data provided by Nigeria Independent National Election Commission (Inec) to tally di results of di elections.
Nigeria presidential results 2023
To win for di first round, candidate must get a majority of di vote and ova 25% of di votes for two-thirds of di 36 states and Federal Capital Territory (Abuja)
Last updated: 19/04/2023, 18:00:25 local time (GMT+1)
Final results
Nigeria presidential results 2023
To win for di first round, candidate must get a majority of di vote and ova 25% of di votes for two-thirds of di 36 states and Federal Capital Territory (Abuja)
Last updated: 19/04/2023, 18:00:25 local time (GMT+1)
Final results
Presidential election results by state
Presidential election results by state
Last updated: 19/04/2023, 18:00:25 local time (GMT+1)
Click on di map to see detail of results
Senate results by party
Last updated: 19/04/2023, 18:00:25 local time (GMT+1)
| Party | Seats |
|---|---|
| All Progressives Congress | 59 |
| Peoples Democratic Party | 36 |
| Labour Party | 8 |
| Others | 4 |
| New Nigeria Peoples Party | 2 |
House of Representatives results by party
Last updated: 19/04/2023, 18:00:25 local time (GMT+1)
| Party | Seats |
|---|---|
| All Progressives Congress | 159 |
| Peoples Democratic Party | 104 |
| Labour Party | 35 |
| New Nigeria Peoples Party | 18 |
| Others | 9 |
| Inconclusive | 35 |
Credits
Designers: Millicent Wachira and Olaniyi Adebimpe; Visual Artists: Mayowa Alabi and George Wafula: Data Journalists: Yusuf Akinpelu and Brian Osweta; Developers; Boaz Ochieng, Marcos Gurgel, Ayu Widyaningsih Idjajaand and David Ayoola; Project Lead: Dorothy Otieno.




Nigeria Presidential Election 2023
Who be Peter Obi of di Labour Party?
Who be Atiku Abubakar?
Who be Bola Tinubu of the APC?









