DJ Edu: All di selense photos from BBC This Is Africa tour

Simi, Joeboy, Ycee, DJ Xclusive and plenti odas bin dey part of who join jollificate with DJ Edu as e launch im radio show, This Is Africa

Wetin we call dis foto, DJ Edu, wey be disc jockey wey get one of di longest shows for radio for London land Lagos to show African music to di world.
Wetin we call dis foto, Joeboy, we get hits like Baby and Beginning become di spotlight of di event as im also perform for di launch of BBC This is Africa tour.
Wetin we call dis foto, One of Nigeria biggest female star, Simi kick-start di event, and she tok say events like dis dey important to cari African music go di rest of di world.
Wetin we call dis foto, For totally unplanned move, Ycee wey come to jolly and rep DJ Edu follow drop some sweet tunes for kontri pipo.
Wetin we call dis foto, But no be only Nigerian stars follow perform for di event as Ugandan star, Queen Sheba sprinkle some of her beta jams.
Wetin we call dis foto, As per na Lagos di event dey, pipo wey attend di event follow gbe bodi e.
Wetin we call dis foto, All in all, wia jolly day na wia you go see Africans and even as e be radio program di vibe no dull at all.
Wetin we call dis foto, Di celebs wey dey di event all confess say true-true, dem dey happy for events like dis because na ontop pipo like DJ Edu head, na im African music go global.