NNPC recruitment tie-wrapper as about 60,000 pipo wey write dia job exam

Wia dis foto come from, NNPC
Nigerian National Petroleum Corporation (NNPC) say at least 60,000 candidates write dia computer test to fit get work wit di company.
Isaiah Inuwa, wey be di oga patapata for di company, say di Saturday exam happun for about 94 centers for 22 states across di kontri.
Im say NNPC colobi wit some institutions, to make sure say di thing go well.
Di company say dem wan employ to replace some of dia staff wey dey retire, and to refresh di system wit fresh hands.
E no dey clear how many pipo di company wan employ, for dis recruitment.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2