African Drum Festival 2019: Fine foto and tins wey happun dia

Culture lovers from different parts of di world carri waka enta Ogun state Nigeria to watch di dis year edition of African Drum Festival.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, For olden days, Africa dey use drums dey communicate wit each oda and di community.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, Ooni of Ife, Ooni Adeyeye Enitan Ogunwusi and im wife, Queen Morenike Naomi Oluwaseyi, dey among di ogbonge pipo wey show for di festival.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, Di African drum festival include theatre troupes, custodians of culture and also African culture admirers from around di world.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, Drummers from different African kontries na im show face for di festival.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, Di ogbonge festival dey showcase African culture so dat e no go die.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, Ogun state outgoing Governor, Ibikunle Amosun na im introduce di festival, for 2016.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, Di festival dey bring togeda ogbonge cultural icons, groups and artistes and entertainers all ova African continent.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, Di drum dey carry messages to pipo from one location to di oda.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, Di guests appreciate di works of di pesin wey arrange di festival wey be di outgoing governor of Ogun state, Sen. Ibikunle Amosun.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, For African setting e get special drums wey dey send message of different kind of mood like war, peace, celebrations, mourning, marriages, royalty and worships.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, Dis na di fourth edition of di African Drum Festival wey for Ogun state, Nigeria.

Wia dis foto come from, Ogun State Governor office

Wetin we call dis foto, No be only mouth di Yoruba pipo for South West Nigeria dey use take communicate, dem dey also use different kind of drums.