Katsina Flood: See how flood take scata Jibiya community wia over 45 pipo die

Afta heavy rain on Sunday for Jibiya, Katsina State for northwest Nigeria, BBC Pidgin enta di community to go see di kain serious katakata wey di flood cause.

Wetin we call dis foto, Emergency pipo tell BBC say di water rise reach ontop pipo roof.
Wetin we call dis foto, Pipo property scata anyhow for street.
Wetin we call dis foto, Di flood kill over 45 pipo afta heavy rain fall on Sunday night for Katsina State.
Wetin we call dis foto, Dis man, Raho Auta Jibiya say im use im hand comot ova 30 dead bodi from di flood.
Wetin we call dis foto, Plenti pipo still dey miss sake of di flood wey goment say kill many pipo.
Wetin we call dis foto, Many pipo no get wia to stay, as di flood destroy dia houses.
Wetin we call dis foto, Di flood scata over 500 houses for inside di communnity.