Nigeria: Lagos 5km Cancer Walk dem foto

Organisers say di waka na to ginger support for pipo wey dey suffer cancer, make dem know say dem fit win am; and to stop to stigmatize those wey get am

Wetin we call dis foto, Di 5km waka against cancer na to support pipo wey get am, even as Lagos State government don sign bill to start Cancer Institute to provide care for those wey dey suffer di disease.
Wetin we call dis foto, Dem start with medical check up so dat people go know dia blood sugar level, cholesterol and know dia blood pressure too
Wetin we call dis foto, Dem also do aerobic exercise to warm up and to ginger pipo; organisers say e dey good too to prepare di bodi for long waka like 5km.
Wetin we call dis foto, Those wey waka also release balloons to honour pipo wey die for cancer, because dem be heroes as dem fight am to di last and e good to use dia memory encourage odas to win cancer.
Wetin we call dis foto, Di 5km waka against cancer na also to encourage pipo to stop to stigmatize people wey get di sickness.