#EatDrinkFestival: Food matter dey happen for Lagos

#EatDrinkFestival na one of di big food event wey Eat.DrinkLagos arrange for people to come chop and jollificate for Nigeria economic capital wey be Lagos

Wetin we call dis foto, Di #EatDrinkFestival dey happen for Lagos, Nigeria and na all about food matter
Wetin we call dis foto, Many young people show ground for di food festival
Wetin we call dis foto, Local dishes sef full ground; dis one na Amala and Gbegiri
Wetin we call dis foto, International food join sef show face
Wetin we call dis foto, Celebrity chefs join show for di matter as dem come showcase dia skills
Wetin we call dis foto, People no go di festival to play as dem siddon to enjoy di food
Wetin we call dis foto, No be by slay queen, people no carry last as dem show ground to taste better food
Wetin we call dis foto, Dis seafood paella get shirmp, mushroom, oyester, rice and correct spices make e sweet
Wetin we call dis foto, No be just food wey people come chop, some of dem come taste drink join
Wetin we call dis foto, EatDrinkFestival na big food event for Lagos, Nigeria, wey dey allow vendors sell food to plenty people