Kenya election: Protests for pictures

Tension don dey rise, as people dey vex say di country electoral commission no go fit deliver free and fair election on Thursday 26 October

Kenya protesters
Wetin we call dis foto, People dey enter street for Kisumu, Kenya, to protest against di country electoral commission, wey be IEBC
Kenya protesters
Wetin we call dis foto, Crowd gather for di area, where oppositionleader Raila Odinga get plenty supporters
Kenya protesters
Wetin we call dis foto, Di protesters first start to dey block road...
Kenya protesters
Wetin we call dis foto, ...before dem begin burn fire dey sing dey go...
Kenya protesters
Wetin we call dis foto, Security forces waka come, and dem don begin face di protesters; tori be say at least 30 people don die for protests since di 8 August election
Kenya protesters
Wetin we call dis foto, Many protesters say corruption full di electoral commission; but some of dem fit go court, after dem scatter training wey election officials bin dey do.
Kenya protesters
Wetin we call dis foto, As tension plenty well-well, security forces don surround di office of di electoral commission, ahead of Thursday election