Pictures: Muslims for Nigeria dey enjoy Eid al-Adha

Eid al-Adha na to celebrate di day wey Prophet Ibrahim obey Allah to sacrifice im pickin wey be Ishmael.

Wetin we call dis foto, To pray, all Muslims must face di direction of where di Kaaba dey.
Wetin we call dis foto, Dis na very big event for Muslim calendar, na why people dey like to dress well-well.
Wetin we call dis foto, For dis season, dem dey kill animal like ram or goat, dey share di meat for poor people for area.
Wetin we call dis foto, People must go mosque or prayer ground to pray and listen to sermon from Koran.
Wetin we call dis foto, E reach two million people wey don enter Mecca to do Hajj Pilgrimage dis year
Wetin we call dis foto, Muslims dey always say dis na time for sober reflection, where people go think how their community fit dey peaceful.
Wetin we call dis foto, After di prayer, na jollification - families and friends dem go come together, chop together
Wetin we call dis foto, Even old people no fit stay house as all of them must to come pray, give thanks for di Holy Year.